Police don tori say one man wey bi dey do 19 days fasting don kpai

Nigeria police don com tori say one 58 years old man for Lagos state wey bi dey do 19 days fasting don kpai.

Dem tori say dis mata so happen on Monday for Alagbado area, and according to police, di man younger brother confirm say di man bi dey do 19 days dry fasting and na in di midst of di fasting nai him com kpai, so derefore dem nor suspect any kurukere doings except say dem go let di family prepare for di burial as dem ask.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment