Appeal court don tori say Asue Ighodalo nai bi di ogbonge original PDP gwornor candidate

Appeal court wey sidon for Abuja don tori say na Aue Ighodalo nai bi di confam candidate for PDP for di election wey dem wan hold on September 21st for Edo state.

According to di three-member panel of judges wey sidon for di mata, dem com first troway di former judgement wey bi nullify Asue candidacy before di three member of justice com pass dis new judgement.

As Appeal court dey troway di mata, dem com tori say di person wey carry di mata com court nor bi aspirant, and becos of dat, him nor get any legal working stick to take challenge d election mata wey produce Asue Ighodalo as PDP gornorship candidate.

Dis ruling so don confam say na Asue Ighodalo bi di original ogbonge candidate of PDP for dis September Edo state gwornorship election.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment