Dem don detain some Binance executive because of crypto mata

Tori don talk say dem don detain two binance oga kpatakpata today because of d crypto wahala.

Tori come say d two oga kpatakpata fly come Nigeria as dem here say Nigeria wan ban crypto currency. According to d tori, dem say officials never provide borku informate on why dem detain dem, say dem also block other platforms wey be forextime, octafx, crypto, fxtm coinbase, Kraken and others.

The tori come continue say CBN governor Yemi Cardoso don dey worry say e be like say some kind kurukere market dey happen for those platform wey e be like say dem nor fit trace and dem wan shine better eye dere going forward.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment