FRSC don confirm say road crash don kpai 16 passengers for Benin-Ore road

Di federal Road Safety Corps FRSC for Ondo, don tori with confirmation say almost 16 pipo don kpai from di accident wey involve one motor bus and one truck, and three oda person com get serious injuriy join.

Dem tori say na for Odigbo area for ondo state nai dis accident for happen so for night.

Di Ondo Sector Commander for FRSC, Mr. Ibitoye Samuel, wey confirm dis mata on Wednesday, tok say na over speeding and yeye overtaking nai cause dis accident wey make di vehicles collide den com make di 18-seater bus catch fire wey just kpai di 16 pipo just like dat.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment