Tori tok am say some very very brave citizens of Matusgi village, wey dey Talata Mmafara Local Government Area for Zamfara state don gather kpai almost 37 bandits as di bandits try to wan attack dia community to napkin some citizens for di area.
Dem say di bandits dem bin enter di area around 2pm for afternoon to carry out di napkin mata, nai di citizens of Matusgi com provoke say enof is enof, say today na today as dem don understand say all kpai is kpai, and dem nor go let dese bandits just dey carry out dia business like say dem use okpor cover dem di citizens face make dem nor fit do anytin, but as e come bi now, e be like say di okpor don clear for di citizens face after dem understand di word bravery.
Tori tok say after almost 1 hour of beta gboa gboa between di citizens and dese bandits, d bandits com use style borrow leg as dem see say dese brave citizens don kpai like 10 of dia members, but dese bandits nor still stop for dere, fear com still let dem com back to com carry out another attack, not knowing say di brave citizens dem don already strategize dey wait, na so d villagers wey all of dem bi brave 9ja citizens start to return gboa to gboa before dem com succeed kpai bandits wey reach 37.
Unfortunately, three of di citizens com kpai during dis bravery act according to di district head Alhaji Ciroma Muhammad wey confirm dis mata, him com also tori say dis na di 13th time wey bandits dey attack dem for dis village.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.