Chairman of BUA cement, Abdulsamad Rabiu don tori how cement dealers take frustration di plan wey him bi get to make cement price drop reach N3,500 for we kontri.
The chairman of BUA cement com tori dis mata for dia 8th annual general meeting on Thursday, say all di effort wey dem make take reduce di cement price for consumers nor get way becos say dealers frustrate dat effort. and becos of dat dem nor come fit sustain and kontiniu dat policy to reduce price for consumers make e nor com be like say na dealers nai dem dey help instead of helping di consumers.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.