Anytin you dey do, try to dey do am well

Di rison why you nid to do anytin wey you dey do well bi say, you nor go boda to luk luk back wen you dey waka, and dat nah beta peace of mind, and dat peace of mind na wetin any amount of money no go fit buy.

So, as you dey start your today, remember your peace of mind wey no amount of money fit buy, and make sure say you dey do anytin wey you dey do well even if nobody dey look you, plus especially wen e com bi say we nor go carry anytin comot from dis world wen time reach.

I pray make dis Tuesday count well well for all of we di pipo.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment