Poyis for Edo don arrest Ibrahim Yahaya Jolly wey bi nadkippa

Poyis for Edo state don arrest one Ibrahim Yahaya Jolly wey dem say him bi kidnap one Igbinosun Evans, wey bi di leader of Ugbogui community for Ovia South-East local gworment area for di state.

Dis informate reach di public as poyis informate SP Moses Joel Yamu take tori am.

According to di further informate wey SP Yamu informate when him parade other suspects for some oda crime matas for di state, him say dem arrest Ibrahim Yahaya di kidnapper after him collect ransom of 7 million naira from Igbinosun Evans family finish, na dere di intelligence rapid response squad com track him reach ground and arrest him, and him com also confess to di crime and still dey corpreation with Poyis pipo so dat dem go fit arrest oda members wey join commit dis crime.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment