Dangote group don tori say na dollars nai dem take sell petrol giv NNPC

Dangote group don com out tori say di statement wey NNPC tori di public say dem buy petrol for N898 per litre nor bi true at all.

 Anthony Chiejina, wey bi di Dangote group chief branding and communications officer tori dis mata say dat statement nor correct, so derefore make di public troway di statement and wait for correct announcement wey di technical team on naira based crude wey presido Tinubu appoint go announce di price.

Anthony com tori further say make pipo dey aware say na dollar dem take sell di product give NNPC wey help dem save plenty borku money from di importation wey dem bi dey do.

Him com assure Nigerians say with dis action wey dem don take, petrol go com berekete for evrywhere even go reach where moto fit nor even pass.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment