D rison wey God give us mouth to tok, and Him with His wisdom com put d mouth for front, and him com put di mouth under our eye and under our nose, so dat as your eye dey see di tin, your nose go dey breathe heavily and u go open your mouth dey shout make world pipo hear am.
At least if one nor hear two go hear, if two nor hear three go hear, and I guarantee yu say dese days, before yu go even open your mouth sef world pipo go hear am evrywhere dem dey, except say na yu nor open dat mouth.
Now, why I tori dis mata as yu dey start your day na becos of dat three storey building wey collapse for Uniben side wey some students come go trap inside, but thank God say according to Edo state gworment dem remove evrybodi wey bi dey trapped inside di collapsed building.
So, if yu sabi how to use your tongue take count your teeth, yu go understand wetin I mean by if yu see somthing say somthing especially on top dat voice note wey some pipo dey share upandan.
Make we, yes us, pipo for dis we kontry try to dey try small, if institutions nor sabi regulate to do dia work, u sef try fear God and regulate yourself, na God we use take beg una, becos e nor get where anybodi dey carry di money dey go.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.