Dem say di Oyo state executive council don approve di sum of N63,479,858.000 make dem take renovation di gworment house.
Na on Wednesday wey just pass so nai dem tori say dis governing council com approve dis amount wey brekete borku for everywhere so.
Dotun Oyelade wey bi di commissioner for information and orientation for di state com tori say di rixon wey make di executive council dem approve dis amount for di renovation bi say di current gworment house bi like embarrassment, and on top of dat both di gwornor and di deputy gwornor dey stay for dia personal house instead of di official residence wey bi di gworment house.
Him com further tori us say di banquet house go complition before di 50th anniversary of di state.
Di tori com further tori us say that billion billion wey dem approve so nor go reach to dey maintain green areas and oda some kai places for gworment house, so deredore dem com still approve another borku N131,751,530 to employ professional gardeners for dose maintenance.
Oyo state una doh o, so we di people go plan to com dey use dat place as tourist attraction place wen dem eventually complition am with all dis brekete money wey be some kontry yearly budget.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.