Our pipo for Benue IDP camp dey ask say wey di food wey di aid wey di relief materials?

Our brothers and sister, mama papa and pikin dem wey dey one IDP camp for Benue state especially becos of di recent kpai kpai wey just happen few days ago for Yelwata don come out come protest heavily for Makurdi say dem wan use hungry take kpai dem finish o.

Dis our pipo wey need help like yesterday don cry com out dey accuse di state gworment and officials for di camp say dem dey hide and divert di relief materials wey pipo wey get beta mind don donate for dia welfare cos of wetin happen.

Di protesters com use dia protest against dis bad thing wey dem dey accuse dis officials for take block road near di Makurdi international market, some of dem come carry placard wey dem write say hungry wan kpai dem o, dia children dey kpai kpai o and make dis officials stop to dey thief thief di aid wey good Samaritan dem donate give dem.

Some of dem com even tori as two pipo don take kpai since yesterday due to hungry plus sickness, some of dem come still tori how good Samaritan and religious body including pastor Enenche don take donate relief materials to di camp, but any of di materials dem nor dey see am, say na camp officials dey kolorbi everytin wey pipo dey donate.

Dem com call on well-meaning pipo make dem come to dia aid before hungry go finish everybody for di IDP camp, dem com ask dia gwornor make him visit di camp to com see weder na dat kai place nai human being suppose to dey stay.

Di pipo come vow say dem go continue di protest until dem see change.

How pipo go even open eye dey thief relief materials wey dem bring com give pipo wey dey that kai condition, na only Angel go help us answer dis question

We call di gwornor to attend to dis pipo sharp sharp and bring dem com out from dis inhuman condition wey dem find dia self wey bi say nor bi dia fault.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment