D inspector general of police, Kayode Egbetokun, don ban operators of point of sale wey we know as POS and other electronic mobile money transaction devices comot from police station and police facilities round d country.
Oga IGP tori dis mata on monday say d ban dey necessary at dis time becos of d wayo transaction of POS machine operators with some police officers for we country.
ACP Olumuyiwa Adejobi wey be d police public relation officer come further tori d mata say d directive from IGP na to preserve d integrity of d police and any command wey dem catch dey go against dis order dem go deal with them well well while the POS operative go face better punishment.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.