D Governor of Plateau State, Caleb Mutfwang don tori say na Buhari administration nai cause d hardship wey Nigerians dey face right now.
Him tori dis one on monday when im dey swear in 22 special advisers and heads of government agencies for government house Jos. D governor come talk say dem sell Nigeria future under d last administration wey dey under Buhari sotey dem print a whole 30 trillion naira and just share am.
D governor come continue to tori say e owe d people d truth even though im belong to another party and dat truth nai be say dem even sell oil wey never comot for ground in advance under Buhari administration.
D governor come still tori say dem get plans to set up special agro-processing zone for Barkin Ladi local government area with partnership with African development bank to d amount of $300m, e come advised d new appointee wey im just swear in to work for d good of d people.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.