President Bola Tinubu talk say im administration wey never reach one year don attract $30 billion direct foreign investment commitments to help boost d Nigerian economy.
Tinubu tori dis one for d 2023 Leadership annual conference and award for Abuja.
D event, wey get d theme “An Economy in Distress: The Way Forward”, wey d Leadership Group of Leadership Newspapers organized.
Tinubu, wey d minister of Information and national orientation, Alhaji Mohammed Idris represent for d event , tok say Nigerian economy no dey inside wahala, but e dey face tough times.
Im explain say despite d challenging situation, d country don attract plenty opportunity to reset d course and build new and sustainable economy wey no dey depend on rent-seeking and waste wey dem dey see before.
President Tinubu come beg Nigerians to patient say d reform wey e dey try bring go yield better result.
“
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.