D president of Africa development bank (AFDB) Dr. Akinwunmi Adesina don tok say d future of our youth nor dey d land of any other country but instead na Nigeria here nai dat future dey.
Dr. Akinwunmi tok dis one during d 2023 Awolowo leadership prize ceremony where dem for give im d award.
Dr Akinwunmi com advised say instead of make d youth dey choose to japa, wey nor dey bring about better development, make we d youth take pride in wetin we get as per d youth power to take develop our country, becus according to im, nations wey develop do everything dem fit do to make sure say dem keep their best for house even though dem go give room for small in and out.
E com tori further say im discover say Africa get almost 477 million people under d age of 35 and yet we nor get financial institution, and base on dat AFDB go create youth entrepreneurship investment bank, and on top that AFDB don commit $614 million program wey go support Nigeria digital and creative sector, and dis program suppose create almost 6.3 million jobs and add N6.4 billion to d economy.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.