Abia state police command don catch baby factory for Aba, and dem don rescue 16 pregnant women plus eight pikins, wey be five boys and three girls, during d operation wey dem carry out on Thursday evening.
One police officer from d rapid response squad wey dem for parade d women on Friday, com tok say dem rescue d women based on d information wey d people wey dey around give dem.
D rapid response squad officer tok say, d building wey all dis for happen so, na for one four storey building with 10 flats, wey anoda building still come dey inside d compound.
D officer come tori further say, even d person wey dey behind dis baby factory wey dem dey call Onyinyechi still even get belle, and dem make sure say dem catch all of dem plus one man wey e name be Ekpene wey dey stay inside d compound
D officer com tok say dem still dey find others dey go as dem don start to investigate.
Authorities com tok, especially d state commissioner for women affairs and poverty alleviation, Mrs. Ngozi Felix, wey her permanent secretary, Mrs. Ogechi Oguama represent, com thank d police for d good work wey dem dey continue to do and say d government go take am upon demselves to help d people wey police rescue.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.