Nigerians for abroad don lament say CBN wey be central bank of Nigeria nor carry dem along on top d NIN linkage matter.
Na Clement Osuya wey be d presido of d world united consumer organization nai tori dis mata for one interview, im talk say CBN nor even give any direction on d way forward for Nigerians wey dey d abroad on how dem go take waka for d linkage of d NIN wey CBN say d deadline nah March 1st 2024 wey don already pass.
Osuya com beg CBN make dem look into d mata well so that Nigerians for abroad go fit comply.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.