NANS say make dem give student 5years after NYSC to take repay student loan

Di National Association of Nigerian Students, don tok say e nor go dey possible for student wey take loan to pay back within two years after National Youth Service Corps.

Dem tok say people wey dey get work after NYSC nor dey reach ten percent, so derefore dem dey ask make di student loan repayment start 5 years after NYSC.

Na di association president, Lucky Emonele, nai tori dis one on Monday during di public hearing wey di senate committee on education and TETFUND and di house of representatives committee on student Loan, scholarship and higher education financing organize.

Lucky Emonele com thank presido Tinubu on how im take listen and make sure say di leadership of NANS get representative for di loan board.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment