TC Okafor don tok say na lack of experience nai cause di boat accident wey Junior Pope for kpai

Actor TC Okafor wey be one of di person wey survive for di boat accident wey kpai Junior Pope, don tok say na experience wey di boat driver no get, nai cause di accident.

Di actor and skit maker wey don already tok say from now on, im go only focus on e comedy career, com narrate how di accident take happen.

TC tori say na only di director and DOP of di supposed feem location wey dem bin dey go, nai wear life jacket, and as di boat dey drive dey go, Junior Pope com dey do live video, after im TC ask everybodi to keep their fone for deir pocket.

Okafor com tori further say, wen d driver of di boat see say Junior Pope dey do live video, im com dey try to bring im head com out for di video so dat e face go show, and on top of dat im d driver com wear ear piece. TC com say as d driver dey try to force im head inside Junior Pope live video, e nor com see d small canoe wey dey try cross in front of dem, and becos say im wear earpiece, e nor com still hear wey im TC dey try tell am say see canoe dey im front, and before di driver go realize e com be like say e don too late, and sake of say di driver no com still get experience, im nor com know how to manoveur di boat to avoid di canoe, and before you know, d boat com go hit di last side of di canoe, na so dier boat come take samasut wey come claim four people live including Junior Pope.

TC com further tori say, na di rope wey im hold on to for di front of di boat nai save him and also help him try to save one of di female crew member wey hold him very tight before oda people wey see dem come rescue dem.

Okafor also narrate how Adanma Luke di person wey get di feem bi com take arrest im becos say di driver accused him say na im block di driver view wey make di driver nor see di canoe before di accident happen, but say dem settle di mata.

Im com say e nor go fit kontinu to dey risk im live becos of acting wey dem nor dey gree pay well.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment