Rivers state govnor Sir Siminalayi Fubara don tok say im administration go support di housing plan wey federal gworment get for Nigerians.
Sir Fubara tori dis one on Wednesday as im reciv di MD of federal housing authority Hon. Oyetunde Ojo and e team.
Di govnor com further tori say dis housing project wey federal gworment plan, go reduce di housing challenge wey both low and medium income earners dey face for di country, and di plan dey in line with deir own plan as dem don plan on how to build about 20 thousand houses for di people of Rivers state
Di MD Hon. Oyetunde com tori say na two rison make dem com Rivers state, and di number one na to pay ogbonge visit to di govnor and di second rison na to let di govnor know of di beta plan wey Presido Tinubu get for di renewed hope agenda to provide houses wey go dey affordable for Nigerians.
Na dere di govnor come troway salute to presido say dem go make sure say dem give di necessary support to di housing projects.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.