CAPPA wey be PAN AFRICAN group don warn Nigerians and others over di vape cigarette wey Burna Boy company dey try distribute

Di Corporate Accountability and Public Participation of Africa (CAPPA) don condemn di five-year deal wey dey between Burna Boy company, BrkFst, and Aspire North America, LLC, wey be subsidiary of Inspire Technology Inc.

According to how dem tori am for deir website, dis deal na for Burna Boy company BrkFst, to manufacture and distribute vaping products for Nigeria, Ghana, South Africa, and Europe.

According to di CAPPA executive director Akinbode Oluwafemi wey tori say, dem nor go gree for di deal becos say na strategy from tobacco companies to use social media and artist like Burna Boy take make people believe say vaping dey safe especially among people wey dey young, meanwhile dis na di same vaping wey dem don ban for almost 34 countries, while US and China com get very strong regulations in place even though dem use style permit di vaping.

Akinbode come further tori say, even though dem dey claim say e-cigarettes contain small of di toxic chemicals wey dem dey see inside smoke from normal cigarette, him com say di aerosols from e-cigarettes still contain harmful and dangerous substances wey include nicotine, volatile compounds, heavy metal like leads and carcinogens.

As dem dey tori further, na dere Zikora Ibeh, wey bi di CAPPA’s Policy and Research Analyst, com ask Nigerians and di gworment to shine eye well well for all di wayo wayo wey dey dis tobacco industry dey try to do, becos dem dey try to scata di plenty success wey dem don dey achieve since to control tobacco. According to im, dis wayo tobacco industry borku for black market with new nicotine products wey dem dey tell people say e dey safe meanwhile e no safe and e just be like d normal cigarettes..

Na dere Ibeh com ask di gworment, di public health advocates and both di general public to shine eye well put for dis deadly products and deceitful claims from dis industry.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment