Citizens don dey lament wetin happen to OKIN biscuit factory wey be dey dat year

One of our active citizens don com lament d yama yama state wey Okin biscuit factory com dey.

Na active citizen Mayowa na share am for im X handle how dem take visit di abandoned factoy. Im com tok say na as dem dey com back from Ajasse Ipo for Kwara state, nai dem see di Okin biscuit factory and luckily for dem, dem allow dem enter just to see. Na dere dem shock to see di yama yama abandon state wey di factory com dey.

Citizen Mayowa com tok say what a shame, but We di people com dey imagine for our mind how many citizens for just get job for dis place if to say di factory dey work now now now as me and you dey tok so.

See below as Moyawa take tori am for im X handle.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment