Di Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC), don close one Chinese supermarket wey dey China general chamber of commerce for Abuja. And na on Monday nai dem close am, sake of say di Chinese supermarket nor dey allow Nigerians enter to buy anything and dis na wetin oyibo dey call discrimination.
Di closing of di Chinese supermarket happen after one of our active citizen com hala well well for him X handle. According to one of di video wey our active citizen share, im com tori how im bi take go buy something for di supermarket, and as im reach dere, dem nor com allow him enter becos according to di chinco people, dem nor dey allow Nigerians enter. Na dere, di authority of FCCPC com go visit di place to go confirm weder wetin our active citizen eye see na tru.
Tori further tok say as FCCPC officials com start to question some of di Nigerians wey dey work for dere dey dem self com agree say na true, say di Chinese supermarket banned Nigerians make dem nor enter di supermarket wey dey inside deir own kontri, na dere FCCPC officials for com provoke and close di Chinese supermarket.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.