Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don file new charge against former govnor of Central Bank of Nigeria Mr. Godwin Emefiele, sake of say im use N18.9billion take print N684.5million notes.
Na for High court Abuja nai EFCC for file dis new charge against Godwin Emefiele, and com tok say na im approve make dem print N684,590,000 with N18.9billion.
Dem com further tori for di charge say di former CBN govnor broke di law becos im purposely harm di people of Nigeria during di time of former president Buhari wey naira swap happen.
EFCC com also accuse Emefiele say im withdraw N124.8billion from di consolidated revenue fund wey dey di Kontri.
Dis new charge, dey follow plenty borku charges wey di Agency don charge di former CBN govnor, especially di one wey im take go sidon inside cell before im come get im freedom.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.