Di power of organized community

One tin wey I see for one of di abroad wey I travel go one certain time like dat, na say, I see as dia gworment for dat particular kontri take take advantage of di community, and use di people of evry community take better dia community and eventually di whole of dia kontri..

And e com happen say as dem dey beta di community dey go, I com dey surprise say evrybodi for di community use style know each oda, dem dey know when stranger enter di community, and since dem com even get community police wey dey patrol evry where day and night, and make dia contact number dey available to both old and young, di community pipo dey always report to police if dem notice anytin new or dem fit say some kind kurukere dey happen for corner, and becos dem empower dia community police, once dem place dat call like dis, before you stretch your leg police don show for area.

And di more guder tin for dis power wey dey inside dis community bi say, almost evrywhere for dis di abroad wey I be travel go, look di same, from day and night electricity, to clean tap water wey di pipo dey drink, from beta beta suku, to beta world class hospital, to clean market, to good road with different layout wey di community officials dey use di tax wey di community pipo dey pay take dey maintain evry year, to beta quality leaving, plus security, sotey di community pipo dey run three different work shift evry day, 24 hours almost 365 days a year, becos say u fit waka for night and no fear say unknown mengun go weylay u for road, and all dis dey possible becos di pipo of di community and dia leader wey be like di one we dey call councilor for naija, make sure say tins dey work starting from di rule of law no mata who u be for di community.

So, I sidon dey tink di mata, how e dey very possible to take empower pipo for community for dis our very dear Kontri naija, nai bi make us get councilor, get local gworment chairperson, den com get state gwornor. I com still dey tink weder e get anybodi wey swear say tins nor go ever work well for dis our kontri or na we just dey do our self? since one person tok say, if to say swear dey work, swear for don kpai all di pipo wey dey embezzle di money wey belong to evry citizen for each state. But somebodi else com tok say di swear dey work, and e don start to dey affect di pipo and dia generation unborn wey dey embezzle di money wey belong to evry citizen of each states, and carry dat embezzlement go kontri wey don already beta finish dey go buy house for dere instead of building dia state. D person dey sweat dey tok am, say make I just know say di swear wey pipo dey swear give any bodi wey embezzle our money dey work.
I nor com know di one wey I go beliv, all I know bi say, na empowered pipo for empowered community I dey look for.

Di pipo for evry community know wetin dem want and wetin dem need, na pipo dey build dia commuity, dia state, and eventually dem build dia nation, and di gud tin dese days be say u nor nid to go moon to go learn how to build community, empower di pipo, get empathy for di community, get 100 years master plan for di community even if na only one thousand pipo nai dey di community at present, and make dis empowerment even start with you di official, if di community pipo see say you dey obey di law, dem go follow you obey di law, if dem see am say di law punish anybodi wey brake di law no mata who di person bi for di community, dem go obey di law becos dem go don already see am say punishment dey for anybodi wey go brake di law.

My hope be say one day evry where for dis one dear kontri, from Asokoro to di last community community for Zamfara and di community for all we states go look di same as e bi for dat di abroad community wey I see dat day.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment