Remember say di Nigeria Labour congress NLC, don dey waka upandan since for dis salary increase for workers, base on di inflation wey almost everybodi dey face for di nation.
We go say base on dis, Tinubu gworment don finally approve almost 25-35% increment for civil servants, and health sector dey among dose wey benefit from dis increment through di Consolidated Medical Salary Structure (CONMESS) and Consolidated Health Sector Salary Structure (CONHESS), as tori tok say some other sectors bi don first get dia increment.
Na di Head of Press, National Salaries, Incomes and Wages Commission (NSIWC), Emmanuel Njoku nai sign on top dis statement of increment mata, say di increment go start from January 1, 2024.
Tori further tok say gworment com still approve di increment for pensioners and di increase go still start from January 1,2024.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.