Di Nigerian Education Loan Fund (NELFund), don tori say dem don disburse N2.5bn to 12 schools across di country for di application wey dem receive from 22,120 students.
Na Nasir Ayitogo wey be spokesperson for NELFUND nai tori dis mata for one of im statement on Friday for Abuja, im com tori further say dem carry out dis disbursement according to as every school calendar year take dey resume.
Dis images na from Nelfund website- (nelf.gov.ng)
Oga Nasir come tori further say, all di amount wey dem don give di number of schools don reach around N2,026,163,340 and dem go still disburse more give anoda six schools in di coming week.
According to di tory, dis loan wey students reciv so, go com help make sure say dem nor get any interruptions with dia school activities, wey go still help give dem and dia parents peace of mind. And on top of di loan, students go still receive money for dia upkeep.
Him com still tori say, dis na presido Tinubu initiatives to make sure say dem remove burden from di shoulders of di student wey really nid di loan, and also help create education opportunity for every Nigeria.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.