Our brothers and sister, mama papa and pikin dem wey dey one IDP camp for Benue state especially becos of di recent kpai kpai wey just happen few days ago for Yelwata don come out come protest heavily for Makurdi say dem wan use hungry take kpai dem finish o. Dis our pipo wey need help like yesterday don cry com out dey accuse di state gworment and officials for di camp say dem dey hide and divert di relief materials wey pipo wey get beta mind don donate for…
Author: wedipeople
When dem say talent full Nigeria, na one of dem bi dis for dis video
So, watch as dis our 9ja pikin take arrange wireless power bank sharp sharp. We pray say one of our pipo wey sabi see tomorrow go look for am and ask am how e go take move dis better vision forward.
63 billion naira to renovate gworment house for Oyo state
Dem say di Oyo state executive council don approve di sum of N63,479,858.000 make dem take renovation di gworment house. Na on Wednesday wey just pass so nai dem tori say dis governing council com approve dis amount wey brekete borku for everywhere so. Dotun Oyelade wey bi di commissioner for information and orientation for di state com tori say di rixon wey make di executive council dem approve dis amount for di renovation bi say di current gworment house bi like embarrassment, and on top of dat both di…
See as Pastor Enenche take advise say make dem go give di 30 milla to orphanage
According to the tori wey una dey see for dis church gist video, Pastor Paul Enenche wey bi di pastor of Dunamis International Gospel Centre come go hold crusade for Kebbi state, na dere we di pipo for see say some men come mount di podium say di gwornor of di state say make dem come giv di Pastor 30 million naira, that is to say Kebbi pipo money, like tax payer money. But as di men wey we dey look ayanyan so dey announce di amount wey dem say…
Ugandan young people make una gather here
We say make di young pipo of that our sister kontry wey we dey call Ugandan gather here, make we ask them small question regarding dis video wey dey fly upandan for social media. Pipo dey ask say weder dem use wrapper cover di face of di young men and women wey dey Ugandan? As e come be nah, na only di young pipo of Ugandan nai go fit answer weder dem use wrapper cover dia face for inside dia kontry, but in d mintime na di videos wey dey…
Inside Di VAT Pool sharing for Kontri..
According to as FAAC take tori am, dem tori say regions for kontri reciv VAT sharing as dem still take contribute am for Q1 of year 2025. FAAC tori say , Southeast Contribute N28.37bn and dem reciv N104.50bn, wey come make dem receive 368% of wetin dem contribute. Dem say Northeast contribute N30.04bn and reciv N124.20bn dat is to say dem receive 345% of wetin dem contribute. E come follow by Northwest wey contribute N68.05bn and reciv N176.74bn, which is to say dem reciv 260% of wetin dem contribute. Na…
NAF don start to cari voting materials go Benin for di election
Di command for Nigeria Airforce don tori on Wednesday say dem don start to carry di INEC voting materials with plane go Benin for di election wey go happen on Saturday September 21 for Edo state. Dem tori say dis na to make sure say di materials deliver on time and securely according to di statement wey Group Captain Kabiru Ali wey bi di deputy director of public relations and information for NAF tori. Him tori further say dis voting materials wey plane carry so, na di collabo effort between…
Poyis don arrest one 9ja John Ogais wey dem know as rambo wey dey torture migrants for Libya
Tori tok say John Ogais known as Rambo for Libya wey dey give migrants beta torture plus di many many borku crime wey him don commit between Libya and Sicily before poyis come go arrest am. Ogais according to tori dey 25 years, and di crime wey dem dey arrest him put so com start with kidnapping, sexual violence, aggravated homicide, and facilitating illegal immigration. According to di tory, Rambo torture migrants for Libya nor bi small, plus say if e torture dem finish, and di person nor com fit…
Former head of state Abdusallami don tori say palliative nor bi solution to dis hardship
General Abdusallami wey bi former head of state don tori say, di hardship for Nigeria don dey go pass out of control and at dis time e com bi like say palliative nor bi di solution. General Abubakar tori dis mata for one meeting wey him for reciv di leadership of di campaign for democracy and human rights on Tuesday for Minna Niger state. Him tori further say federal gworment suppose do sometin about dis hardship with beta sit belt and drive with immediate alacrity, and one of di seat…
If yu see sometin say sometin
D rison wey God give us mouth to tok, and Him with His wisdom com put d mouth for front, and him com put di mouth under our eye and under our nose, so dat as your eye dey see di tin, your nose go dey breathe heavily and u go open your mouth dey shout make world pipo hear am. At least if one nor hear two go hear, if two nor hear three go hear, and I guarantee yu say dese days, before yu go even open your…