Federal high court for Abuja don fix September 19th,2024 as di day wey dem go hear one mata wey APC carry com say make dem disqualify Asue Ighodalo from di Edo state gwornorship race. But so far, INEC di electoral body don tori say make court troway di mata as Asue Ighodalo remain di ogbonge authentic candidate of PDP for di gwornorship election.
Author: wedipeople
Some 9ja women wey dey prison for Libya don cry comout say dem nid help
One video wey dey all over social media since, don show some of our kontri sisters for Libya wey nid beta help from gworment. Dis na becos say according to di video, di women dey hala say dem nid help as dem don dey dat prison for Libya for almost two years now. Dem say dem decide to cry out since citizens of oda nation don find way comot from di prsion facility wey dem put all of dem and na only dem wey bi Nigerians nai com remain, derefore…
Power of consistency
Consistency get power becos di more yu dey do sometin over and over again, di more expert yu go get and becom, and na becos say yu stay consistent for dat tin wey yu dey do nai make yu become di expert. And one of di way to stay consistent and becom expert for dat tin wey yu dey do na to kontiniu to encourage yoursef even when yu never see result. So, as yu dey start your dey, I go advise yu to try to stay consistent for that…
Appeal court don still tori say Asue Ighodalo of PDP remain di candidate for di election
Appeal court wey sidon gidigba for Abuja don tok say Asue Ighodalo wey bi di gwornorship candidate for di pipo democratic party remain di authentic candidate for di election wey go take place on September 21 2024. Dem tori dis one as dem troway di mata wey som Pipo carry go court say make dem disqualify Asue Ighodalo sake of say him be nor get beta voter’s card, as dem dey giv d judgement, dem tori say dem dey troway dis mata becos of say di mata lack merit, and…
Peter Obi don ask African Leaders say make dem take farming business serious well well
Peter Obi wey bi di presidential candidate for di 2023 general elections and former Anambra state gwornor don advice African leaders to take agriculture business serious well well so dat dem go fit tackle insecurity and hunger for Africa. Na for di international conference for food security wey dem hold for Kigali for Kenyan nai him for tori dis advice. Obi com still tori further say e go beta to reduce dependency on food importation wey go help to reduce di currency pressure and focus more on food production for…
Quality infrastructure for china go soon dey appear for Nigeria
Presido Tinubu don tori say him go try to start to make di quality beta infrastructure wey him see for China to dey appear for di kontry. Presido tori dis mata give Nigerians wey settle gidigba for china wey dem dey call Nigeria diaspora organization for China chapter, presido tori say im ready to create di leadership wey go move di nation forward. Him com tori further say China na very discipline society so make di Nigerians wey dey stay dere learn discipline and represent Nigeria as good citizens.
FG don tori say di fuel scarcity wahala go reduce dis weekend
Federal gworment don tok say plenti borku fuel dey di kontri, and base on dat fuel scarcity go reduce afta dem address di distribution issue. Na Sen. Heineken Lokpobiri wey bi di minister of state for petroleum resources nai tori dis one afta him and Vice President Kashim Shettima hold meeting finish. Di minister tori say gworment dey do everytin possible to make sure say dis fuel scarcity so wey dey cos beta hardship for we citizens become a tin of di past Him com still tory say gworment nor dey…
Take one beta dip breathe
As you dey start your day, just know say sometimes di only tin wey yu nid to do na just to take a dip breath and relax, and den assure yourself say everytin go must surely dey alright. Usually, notin dey ever stay di same, e dey go dey com, and di earlier yu advise urself say notin dey stay di same, plus say notin dey new under di sun, di more focus and relaxation yu go put yourself, as far as say yu know say yu nor dey deciv…
Poyis for Edo don arrest Ibrahim Yahaya Jolly wey bi nadkippa
Poyis for Edo state don arrest one Ibrahim Yahaya Jolly wey dem say him bi kidnap one Igbinosun Evans, wey bi di leader of Ugbogui community for Ovia South-East local gworment area for di state. Dis informate reach di public as poyis informate SP Moses Joel Yamu take tori am. According to di further informate wey SP Yamu informate when him parade other suspects for some oda crime matas for di state, him say dem arrest Ibrahim Yahaya di kidnapper after him collect ransom of 7 million naira from Igbinosun…
Nigeria electricity generation don reach 5,313MW first time in 3 years
Minister of power, Adebayo Adelabu, thru him special adviser for communication and media relations, Mr. Bolaji Tunji, don tori say for di first time in 3years, electricity generation don reach 5,313 megawatts. Di minister com tok say him go advise electricity distribution company wey bi Discos to collect more power so dat di national grid nor go collapse again, according to am, him say if Discos nor pick power when dem production energy, e fit lead to collapse of national grid. Di minster com further tori say, by di end…