Poyis for Nasarawa don arrest Isa Usman wey bi fake docitor, sake of say him go give one patient wey dem dey call Zaki Yaka Ajohol procaine injection wey him say him take dey treat typhoid for Zaki Yaka, wey com later kpai Zaki di patient. Dis mata happen on Wednesday for Iyayi village wey dey Kadarko district of Keana local gworment area for Nasarawa. According to poyis informate, DSP Ramhan Nansel, wey confirm di arrest, com tori say di fake docitor wey com from Gombe state only get primary…
Author: wedipeople
Nigeria electricity generation don reach 5,313MW first time in 3 years
Minister of power, Adebayo Adelabu, thru him special adviser for communication and media relations, Mr. Bolaji Tunji, don tori say for di first time in 3years, electricity generation don reach 5,313 megawatts. Di minister com tok say him go advise electricity distribution company wey bi Discos to collect more power so dat di national grid nor go collapse again, according to am, him say if Discos nor pick power when dem production energy, e fit lead to collapse of national grid. Di minster com further tori say, by di end…
Bill Gates say for Africa na Nigeria dey benefit pass from dia foundation
Bill Gates wey be co-chairman of di Bill and Melinda Gates foundation don tori say na Nigeria nai dey receive di largest intervention fund for Africa. Bill Gates say him understand why e bi like dat since na Nigeria nai still get di highest population for Africa, and na during di NutriVision wey him and some tori pipo dey rub mind for Abuja nai him for tori dis one, him com tok say him don really spend billion on top Nigeria. Him com tori further say e top priority na…
Kim Jung-un don kpai 30 of e official becos of flood wahala
Tori dey informate us say, Kim Jung un, wey bi di leader of North Korea don execution as in kpai 30 of e officials becos of flood wahala wey dem say kpai almost 4,000 pipo for di kontry. Tori say dem charge dis officials wey dem kpai so with corruption and say dem neglect dia duty nai make di flood fit kpai 4,000 pipo like dat. Kim Jung-un don tori say him nor go collect any aid from anybodi even doe say di flood don pursue almost 15,000 pipo comot…
Dangote don promise Nigerians say dia motor go com dey last well well as from now
Aliko Dangote, di oga kpatakpata of Dangote group don tori say, since him don succeed to make di petrol mata wey bi dey get kleg since work, make Nigerians know say dia motor from now on go dey last well well, sake of say di petrol from Dangote refinery pure nor be small. Dangote tori dis one as him dey tori di pipo for one press conference for Lagos, him com tori join say, dis petrol from Dangote refinery pure so tey nobodi for di world in terms of quality…
Na small small drop of water dey become swimming pool
I beliv my reader, say yu slip very well, as person tok, na wen person open eye for morning nai bi e early morning, but we thank God for di gift of life and di blessing to see anoda day. As yu start your day, I just wan remind you say, concerning dat your potentials wey God giv yu, wey yu know say God giv yu, and wey me and yu know say na everyday nai yu take dey put your hand for your jaw dey say chai, I wish…
Nigeria don dey prosecution 2 chinco pipo and others for illegal mining
Nigeria gworment don charge seven suspects wey include two Chinese pipo go court becos of illegal mining activities for Kogi and Ondo state. Na di mining marshal wey bi di enforcement unit wey dey regulate and secure mining sector for Nigeria nai arrest all d suspects for one new operation wey dem carry out. According to di tori dem don charge all di suspects go court for Abuja.
Fuel production don start for Dangote refinery
Dangote group don announce say dem don start to production petrol for dia refinery, and dis beta news go help address di fuel scarcity wahala for di kontri. Na Anthony Chiejina, wey bi di Chief branding and communications Officer for Dangote group nai tori dis mata on Monday.
Anytin you dey do, try to dey do am well
Di rison why you nid to do anytin wey you dey do well bi say, you nor go boda to luk luk back wen you dey waka, and dat nah beta peace of mind, and dat peace of mind na wetin any amount of money no go fit buy. So, as you dey start your today, remember your peace of mind wey no amount of money fit buy, and make sure say you dey do anytin wey you dey do well even if nobody dey look you, plus especially wen…
Enugu gwornor don honor Mike Ejeagha di gwo gwo gwo ngwo master
Enugu state gworment don rename one Obinagu road wey bi popular well well to Mike Ejeagha road for Abakpa Nike for Enugu state. Remember say Gentleman Mike Ejeagha as dem dey call him nai bi di 93 years old wey sing gwo gwo gwo ngwor wey don go viral since after Brain Jotter wey bi content creator use am take do dance challenge. According to as di Enugu state gworment take tori am as him dey commission di road, him say apart from say dem name di road after di…