Di National Association of Nigerian Students (NANS) don tori say dem go start protest within 72 hours against di National Emergency Management Agency NEMA wey dem NANS dey accuse say dem use wayo wayo take divert food commodities wey belong to poor Nigerians. According to di statement wey NANS deputy senate presido Huzaifa Sabo Usman signed, dem tori say dem wan use di protest take draw Nigerians attention to how NEMA take use wayo divert almost 42,000 metric tons of food wey belong to di poor for kontry. NANS com…
Author: wedipeople
FRSC don confirm say road crash don kpai 16 passengers for Benin-Ore road
Di federal Road Safety Corps FRSC for Ondo, don tori with confirmation say almost 16 pipo don kpai from di accident wey involve one motor bus and one truck, and three oda person com get serious injuriy join. Dem tori say na for Odigbo area for ondo state nai dis accident for happen so for night. Di Ondo Sector Commander for FRSC, Mr. Ibitoye Samuel, wey confirm dis mata on Wednesday, tok say na over speeding and yeye overtaking nai cause dis accident wey make di vehicles collide den com…
Pipo for Sokoto don provoke enter forest to go confront bandits by diasef and rescue victims
Thousands of pipo from Gobir wey dey Sokoto state don provoke enter forest, say dem wan go by diasef confrontation bandits wey dey terrorize dem since for dia community. D pipo say since security officials nor fit protect dem, dem don take matas into dia hand to enter bush by diasef, and dem dey sure say dem go must rescue about 150 victims wey dese bandits carry comot. But police don tori say dem nor get any informate about 150 pipo wey dem napkin comot from Gobir Emirates for Sokoto.…
Abike Dabiri wey bi NIDCOM oga don release d face of di woman wey say she go kpai 9jas for Canada
Di chairman of Nigeria in Diaspora Commission NIDCOM, Abike Dabiri-Erewa, don release di foto of di woman wey dey rake up and down for social media say she go kpai some Nigerians wey dey stay Canada. Dem tori say di woman wey her name bi Amaka Patience Sunnberger and oda pipo dey get some discussion for TikTok space when she start to vibrate say oda tribes don too sidon for Igbo pipo head, and time don reach to kpai pipo from dis tribe, according to her vibration for TikTok, she…
Dem don jail four 9jas for UK wey dey forge marriage documents
Four 9jas don land for jail after dem forge more dan 2,000 marriage certificate take dey help oda japaris to stay UK illegally. According as di UK home office take tori am, dem say dese 4 9jas wey dia names na Abraham Alade Olarotimi Onifade, 41, Abayomi Aderinsoye Shodipo, 38, Nosimot Mojisola Gbadamosi, 31, and Adekunle Kabir, 54, dey among pipo wey dey commit crime of EU settlement scheme for oda Nigerians, and base on dis, dem com conviction dem for Woolwich Crown Court for London on Tuesday, August 27…
Dem say na 8 states nai clean pass for 9ja
Di National Technical Study Group (NTSG) don tori say off all di states for 9ja, na only 8 of dem clean well well. Dem tori say Akwa Ibom nai be number one cleanest state for 9ja folo by Ebonyi, before Cross River com folo, den Enugu com tanda dere as Delta com folo, Edo com join, Plateau com folo as number 7 and Abuja come bi number 8. Clean healthy environment is very key for everybody wellbeing.
Appeal court don tori say Asue Ighodalo nai bi di ogbonge original PDP gwornor candidate
Appeal court wey sidon for Abuja don tori say na Aue Ighodalo nai bi di confam candidate for PDP for di election wey dem wan hold on September 21st for Edo state. According to di three-member panel of judges wey sidon for di mata, dem com first troway di former judgement wey bi nullify Asue candidacy before di three member of justice com pass dis new judgement. As Appeal court dey troway di mata, dem com tori say di person wey carry di mata com court nor bi aspirant, and…
171 Nigerians don return from Libya
National Emergency Management Agency (NEMA) don tori say dem don repatriate 171 Nigerians from Libya. Dem tori say dem receive dis our brothers and sisters for di Murtala Mohammed International Airport for Ikeja Lagos around in di evening, and among dem ma both grown men, women and children. Dem com tok say dem nor record any medical case with the returnee. According to di tori, dem say many Agencies com tanda for ground to give support to dis our brothers and sisters wey just return, and on top of di…
Agency don giv beta warning to petrol station wey dey sell above di normal price
Di Nigeria Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA) don tori say dem go start to close any petrol station wey dey sell above di approved price. Di Agency com tori say dem don receive report of some independent marketers wey dey sell petrol for N900-N1000 per litre. Dem tori say di price wey NNPC approve nor suppose pass N650 for a litre.
US don donate 10,000 Mpox vaccine give Nigeria
Nigeria gworment don receive di 10,000 doses of vaccine wey US gworment donate give dem to take helep with di Mpox outbreak. Dem com deliver dis doses of vaccine through di US Agency for International Development wey we know as (USAID) Nor forget say Mpox na one serious viral disease wey dey affect both human being and animal, and person fit get dis infection from close contact with another person wey get di infection, dem fit contact am through bodily fluid and long physical contact including sex. According to tori,…