Blog

Enugu gworment don approve N163bn make dem take construction 161 roads

Di secretary to di state gworment (SSG), Prof. Chidiebere Onyia, don tori yesterday to tori tori people for gworment house say, di state gworment don approve N183 billion make dem take construction more roads round di city, and nearly 20 of dis road go dey inside community wey oyibo dey call rural area, and dis go be for di three senatorial districts. Oga SSG also tori say dis dey happen becos of di plan wey gwornor Peter Mbah get to grow di state economy from $4.4 billion to $30 billion.…

NDDC don ask youth to register for di 6bn training scheme

Niger Delta Development Commission (NDDC) don tori youth wey dey Niger Delta say make dem take advantage of di special training wey di commission don set up wey go help dem acquire some kai ogbonge skills wey dem fit market. Na Mr. Chiedu Ebie, wey be di governing board chairman, nai tori dis mata when dem dey launch di youth internship scheme for Port Harcourt on Monday. According to di chairman, him further tori say di scheme go help youth wey go participate dey ready for employment. Dem say na…

22,120 students don benefit from di N2.5bn student loan wey dem just disburse

Di Nigerian Education Loan Fund (NELFund), don tori say dem don disburse N2.5bn to 12 schools across di country for di application wey dem receive from 22,120 students. Na Nasir Ayitogo wey be spokesperson for NELFUND nai tori dis mata for one of im statement on Friday for Abuja, im com tori further say dem carry out dis disbursement according to as every school calendar year take dey resume. Dis images na from Nelfund website- (nelf.gov.ng) Oga Nasir come tori further say, all di amount wey dem don give di…

News dey break say PresidoTinubu go address di people on Sunday August 4th for early mor mor

Di spokeman to presido Ajuri Ngelale, don tori for X wey be formal twitter say presido Tinubu go address Nigerians ontop di end bad gwornance protest wey dey shele since August 1st 2024 for nearly all di states for Nigeria. According to di way Ajuri Ngelale take tori am, im say di presido address go happen on Sunday wey be August 4th 2024 for around 7am and make all di media house tune in.

Nigeria Youth Investment Fund (NYIF)

Dis na to remind our ogbonge youth say, make dem take advantage of di N110 billion youth investment fund wey presido approve. According to di informate wey dey di youth ministry website, dem say di reason for dis youth investment fund na To reduce youth unemployment by fostering entrepreneurship.To provide young entrepreneurs with access to affordable finance.To support youth-led businesses in achieving sustainable growth.To encourage innovation and creativity among the youth.To create job opportunities and improve the standard of living. And dis na di criteria wey go make you qualify…

Communication commission don give order to tele company to reactivate all di blocked sim card

Nigerian Communications Commission (NCC) don giv order make dem reactivate all di sim card wey telephone company be block sake of say dem neva link dem to di national identification numbers wey be NIN. Na di NCC director of media and public affairs Reuben Muoka nai tori dis one today for im press release. According to di tori, MTN don already start to dey activate di lines wey dem be block because say some consumers be nor link am with their national identification number. Before then, some consumers bi don…

Presido Tinubu don give support to Dangote for di crude mata

Tori tok today Monday July 29th say presido Tinubu don stretch hand of support giv Dangote on top di crude oil mata wey bi dey get K-leg and bi wan turn oga Dangote to one motivational speaker since when di oda oga com out com tok say di Dangote refinery petrol bin dey one kai. Dem tori say di Federal executive council come support di idea wey presido bring comout to sell crude oil for naira give Dangote refinery and oda new refinery for di kontry. Tori kontiniu say, di…

EFCC say dem remove body from dat tori wey tok say dem dey investigate former gwornors for Kworuption

Di Economic Financial Crimes Commission (EFCC) don tori say, dem nor get hand for dat tori wey dey fly everywhere say dem dey investigate former 58 gwornos for kworuption wey reach N2.187trillion. Na Mr. Dele Oyewale wey bi di head of media and publicity, nai tori dis one on Sunday, im tok say di commission nor get hand for dat alleged investigation tori, and make di general public ignore dat kind tori since e nor dey com from dem.

Some Area for Edo and Delta state nor go see light for two weeks according to TCN

Di Transmission Company of Nigeria (TCN) don tori say light nor go dey for dia Amukpe substation for two weeks. Dem tori say di outage na to help contractors get environment wey dey safe as dem wan put two 132KV transmission tower for Amukpe substation. And becos of dis development, some communities for Edo and Delta state go face blackout for two weeks, becos say power supply nor go too much to Benin DisCo from Adeje industrial, woodland, Mosogar, Sapele and Abraka feeders during dis period wey contractors wan take…

Remove negative thinking from your mind

God give human being di most powerful weapon as Him dey create us com dis life, and Him come use Him infinite wisdom take put dat weapon inside us. Dat weapon if you ask me, na your mind. If you know di power wey your mind carry, you go dey guide your mind with everythin wey you get, especially to guide am from negative/bad thinking. But before your mind go become dat powerful weapon wey you fit take change anytin, you go nid to train your mind well well, and…