Blog

Everyday na fresh start

Everyday wey you wake up and see di morning sun, na fresh start. Dis go mean say, you go try to forget di past and look forward to a fresh, beautiful and successful day. Di rison you nid to do dis na becos, just as everyday na fresh start, na so di day still carry e own baggage, and e nor go good to add yesterday baggage wey don already pass com add join today own wey you never even fit carry. So remember, as you dey start your day,…

Tinubu don approve N100billion as consumer credit for Nigerians

President Bola Tinubu don approve make dem start di N100 billion consumer credit scheme for Nigerians becos of di economic hardship wey dey kontri. Na Ajuri Ngelale, wey bi di spokesperson to presido nai tori dis one on Wednesday. Im com tok say any Nigerians wey dey interested fit visit di portal of Nigerian consumer credit corporation before May 15, 2024. dis na di portal wey di spokesperson say make working Nigerians visit if dem dey interested. “Working Nigerians interested in receiving consumer credit can visit www.credicorp.ng to express interest.…

Take small steps

Dem say na small small water nai dey later com turn to ocean. Nor think say dat small small steps wey you dey take on a daily basis nor go amount to anything, becos before you know wetin dey happen, if you nor give up, dat small small steps wey you dey take since towards di exact tin wey you know say you want, go start to produce beta result. All you nid to do na to encourage yourself and nor giv up, no mata di discouragement wey dey around…

US Presido don sign one bill wey go ban TikTok

Presido of United States, Joe Biden, don sign one bill enter law to ban TikTok app comot from social media for inside U.S. As dem pass di bill for congress, dem com say dem order di company ByteDance wey be like say na China company, to sell di app within nine months, or kuku face di ban from U.S. TikTok official com later release statement say, dem go challenge di mata for court, as dem say dat kind leg wey US presido carry come dey unconstitutional.

Concerning di fire mata wey happen for Bini

Tori tok say fire don happen for mostly medical shops wey dey opposite university of Benin teaching hospital (UBTH). Dem say na one of di shop nai di fire for start before e com spread enter oda shops for dere, and as di fire start, both di federal fire service, di Edo state fire service, di Nigerian Army school of supply and transport Benin, di University of Benin fire service, and di University of Benin Teaching Hospital, UBTH, com try dier best to make sure say dem fit quench di…

One of our sister don rapa from UK back to naija say she don tire

One of our sister don share for her TikTok video wey bi nikkystar_55, say, she tire for United kingdom wey be UK, and decided to com back to naija after two years, dis one na wetin we go call rapa opposite of japa. Our sister say she don tire for di hussle hussle for Uk and finally decide to return to naija, she com still tori say nor be only she and her family, as plenti japaris dese days don dey com back to naija make dem com take advantage…

Peter Obi don reply Reno Omokri about di school mata

Mr. Peter Obi, wey bi di presidential candidates of Labour Party LP for di last general election wey happen for 2023, don com tori why im nor build new schools when im be govnor for Anambra State. Peter Obi tori dis one wen im hold one press conference on Wednesday for Abuja. Na dere Obi com reply Reno Omokri wey be social media influencer wey say im challenge anybody to show school wey di former govnor build for Anambra state di time wey im be govnor, Reno com say im…

EFCC say Former CBN govnor Emefiele use N18.9billion take print N684.5million

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don file new charge against former govnor of Central Bank of Nigeria Mr. Godwin Emefiele, sake of say im use N18.9billion take print N684.5million notes. Na for High court Abuja nai EFCC for file dis new charge against Godwin Emefiele, and com tok say na im approve make dem print N684,590,000 with N18.9billion. Dem com further tori for di charge say di former CBN govnor broke di law becos im purposely harm di people of Nigeria during di time of former president Buhari…

Gworment don suspend operation for Dana Air becos of safety mata

Nigeria gworment don suspend commercial activities for Dana Airline becos of safety concerns, and na on Wednesday nai gworment direct di management of di airline to suspend deir commercial operations. Na di minister of Aviation, Festus Keyamo nai giv dis direction becos of di mata wey happen with di airline for Murtala Muhammad Airport, Lagos State on Tuesday. Remember say d airline be run comot from di Murtala Mohammed airport runway on Tuesday, although say people nor injure, but di general public dey ask questions about di safety mata concerning…