Blog

Conscience, Your own still dey work?

Dis conscience sef, na wetin e mean? conscience na dat feeling or dat voice wey dey inside you, and dey let you know say you don do bad tin or you don do good tin. Di good tin be say, everybody for dis world get dis conscience, so dat nobody go fit lie give theirself, except say dat person don just decide to kpai im conscience finish. Now, dis na wetin conscience dey do, if you bi bad person, conscience go let you know say bi bad person, if you…

Navy don arrest about 75 people wey be wan japa under bottom of cargo ship

Nigerian Navy don tori say dem don arrest about 75 people wey be wan japa comot from di kontri through di bottom of cargo ship, and dat na wetin oyibo dey call stoleaway. According to Commodore Adams Aliu, wey bi di Director of Naval information, dis attempt na criminal offence and e carry heavy consequences if dem catch you. Navy com warn say apart from say stoleaway na criminal offence and di heavy consequences wey e carry, stoleaway na very dangerous way to wan take japa, becos e fit lead…

FCCPC don go lock 4U supermarket

Di Federal Competition and Consumer Protection Commission, FCCPC, don put selotape for di ogbonge 4 U supermarket wey dey Wuse 2 for Abuja, becos say dem dey sell bag of rice wey nor correct and dem com dey hide beta information. Dis kind practice according to di acting executive vice chairman of di commission, Adamu Abdullahi, dey unacceptable, dat is to say di commission nor go gree for dis kind wayo practice. Di commsiison according to tori, com make sure say, base on how people take dey complain say, dollar…

EFCC don declare Yahaya Bello wanted

Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, on Thursday, April 18, 2024 com declare former govnor of Kogi State, Yahaya Adoza Bello wanted becos say im nor gree appear for court for im connection inside alleged money laundering wey reach N80.2 billion. Dis tori dey inside di EFCC website, and dem say anybody wey get information about di corner wey di former govnor dey, make di person contact di commission or di police station wey dey near dem.

Aisha Yesufu say if she bi presido, Kogi governor for nor try wetin im try yesterday for Abuja

Aisha Yesufu wey be human right activist, don tori for her X handle wey we first dey call twitter say, wetin happen yesterday between former governor of Kogi state Yahaya Bello and operatives from EFCC for nor happen imagine say she bi presido of Nigeria. Our current presido na Bola Ahmed Tinubu. Di human right activist com say, e bi like say she for nor gree for anybody, not even di current govnor of Kogi State, Usman Ododo wey tori carry say nai im com stop di arrest. EFCC be…

Abuja high court don troway di cyberbullying and criminal intimidation case against Ijele wey be blogger

Magistrate court for Abuja don troway di case of criminal intimidation, cyberbullying, threat to life, cyberstalking wey dem file against social media influencer Ofoegu Chukwuma wey we know as Ijele. Emmanuel Iyanna wey bi di chief Magistrate nai troway di case becos according to him di case lack jurisdiction. Di chief magistrate com tok say, becos no charge against Ijele for im court, dem fit go arraign Ijele wey be di defendant for federal high court wey di prosecution for first file di charges against am. Minwhile small drama bi…

Wetin bi your purpose for dis life

You don ever take time take sidon and rison wetin make God create you come dis life. I discover say dat na one question wey di majority of us nor dey like ask ourself, and becos we nor dey like ask ourself dat question, we com decide to dey live di life as we see am, which e nor suppose to be like dat. If you go dare, as you dey start your day today, ask yourself say wetin bi dat rison, dat purpose wey make God Almighty di creator,…

Electric shock don kpai one man wey be wan thief cable for Benin City

Electric don kpai one suspected thief wey be go thief electric cable for Benin City. According to tori, di man wey dem never fit identify look like one middle age man, and na di cable wey dey one transformer wey belong to BEDC electricity nai di man be wan vandalize and carry run before di electric com shock am and kpai am. Dis mata happen early mor mor on Tuesday April 16th along Airport road for Benin City. Na dere Mrs Evelyn Gbiwen, wey be di Acting Head, Corporate Communications…