Afrobit singer David Adeleke wey we know as Davido don tori him support for Asue Ighodalo wey bi di gwornorship candidate for di people’s democratic party for di gwornorship election wey go happen on Saturday. Dis na according to him post wey him post for him social media say next gwornor of e mama homeland. Davido mama wey bi late Veronica Adeleke na from Edo state.
Blog
INEC don dey distribution identification tag giv jonalis for di Edo election
Independent national electoral commission wey bi INEC don start to distribution identification card giv accredited jonalis wey go cova di Edo state gwornorship elections on Saturday September 21st, 2024. INEC start to giv dis card on Monday for di Nigeria union of jonalis secretariat wey dey for di state, and according to further tori wey Sam Olumekun tori, say na 721 jonalis go cover dis election from di details wey 114 media organizations upload so far: Sam Olumekun na di national commissioner and chairman for information and voter committee. Him…
Presido Tinubu don visit Maiduguri for di flood issue
Presido Tinubu on Monday don visit Maiduguri becos of di flood mata wey don pursue many of we citizens for dere comot from dia house especially for Borno di state capital. Nor forget say na di way wey Alau Dam take collapse nai cause di flood, of which according to tori, dem don allocate plenty borku money since to make sure say dem fit control dis mata, but wetin di pipo come dey experience now, nor com be like say dem allocate any money put at all. Some Cho cho…
Dangote group don tori say na dollars nai dem take sell petrol giv NNPC
Dangote group don com out tori say di statement wey NNPC tori di public say dem buy petrol for N898 per litre nor bi true at all. Anthony Chiejina, wey bi di Dangote group chief branding and communications officer tori dis mata say dat statement nor correct, so derefore make di public troway di statement and wait for correct announcement wey di technical team on naira based crude wey presido Tinubu appoint go announce di price. Anthony com tori further say make pipo dey aware say na dollar dem take…
Trump say immigrants go know wetin dey if him becom presido again
Donald Trump wey dey contest for di third time for US presidential election don tori say him go stop flights wey dey carry immigrants and suspension resettlement program for refugees if him becom presido for 2024. Trump tori for e social media handle wey bi X say, if dem elect him again, di first thing wey him go do na to deportation all migrant straight, back to di kwontri where dem for dey come, according to am, dem dey invade America. Nor bi small thin for immigrants o.
Dem say make dem start to fine pvc holder wey nor vote
Shehu Sani wey bi former Kaduna Federal law maker don tori say make Federal gworment start to make pipo pay heavy fine if dem collect dia permanent voters card PVC and com fail to go use am take vote. Sani tori dis one for e social media handle wey bi X say dis heavy fine so go help address di wey voters take dey collect dia voters’ card and refused to go use am vote. And according to am, e say di nid to call for dis heavy fine so…
Emmanuel France wey bi nollywood actor dat year don kpai
One of our Nollywood finest around 80’s and even 90’s wey we know as Emmanuel France don kpai. Na Femi Ogedengbe wey work with Emmanuel France tori dis mata for e social media handle say Emmanuel France kpai on Monday. Nollywood don first dey mourn Big Larry wey tori say e kpai on Friday before dis Emmanuel France own com happen on Monday
Dem say no more elephant for Sambisa forest
Borno gworment don tori say dem nor get any elephant again for inside Sambisa Forest Na Mr. Peter Ayuba wey bi di director for forestry and wildlife for di ministry of environment nai tori dis mata say no more elephant for Sambisa forest. Him tori say di rison wey dem nor get elephant again for Sambisa forest na sake of say dem don kpai dem finish wey oyibo dey call poaching, and also becos of say some natural occurrence still affect dem.
Hunters for Anambra don help rescue one kidnapped victim
Nigerian hunters and forest security service (NHFSS) com tori on Monday say dia operatives don free one victim wey dem bi kidnap. And according to dem, dem rescue dis victim along Nri-Enugwu-Ukwu road between Anaocha and Njikoka local gworment areas for Anambra state. Na ACG Mark Okonkwo wey bi di zonal commander of NHFSS for Southeast nai tori dis mata for Abuja. Him tori say immediately dem reciv call from som pipo wey dey pass say dem see say di kidnappers dey try to force person enter motor, nai dem…
INEC chairman don tori say dem ready gidigba to conduct Edo state election
INEC chairman Yakubu Mahmood don tori say dem ready well well full ground to conduct di Edo state election on September 21,2024. Di chairman tori confidently about dis readiness becos according to him dem don provide all di funds wey dem nid to di state office wey dem want take conduct di election. Di INEC chairman tori dis one for Benin wen him do readiness check on how di mata dey play, especially to test di materials for di election.