Tori don report say mama of late presido Umar Yar’Adua, Hajiya Dada don kpai. Dem report say na on Monday evening September 2nd, 2024, nai she take kpai for federal hospital wey dey Kastina, after she bi sick small. Di family say dem go soon com out com announce di burial arrangement.
Blog
Dem don kpai senior special assistant for Edo
Tori dey report say some pipo wey bi suspected gunmen don kpai Mr. Samson Omoarebokhae, wey bi senior special assistant to di speaker of Edo State House of Assembly, Blessing Agbebaku. According to di tori, dis mata happen for August 31, 2024, wen Samson Omoarebokhae dey return from Ozalla community to Uhumora community wey dey Owan West local gworment area for Edo state, nai dis suspected gunmen walay am come kpai am. Ivy Adodo-Ebojele wey bi di special assistant on media to di speaker tori dis mata for di condolence…
FG don tori say dem go invest $800m put for power sector
Federal gworment don announce say dem plan to invest $800 million put for electricity mata make dem take construction sub stations and distribution networks wey go com under di presido power initiative. Dem tori say dis investment so go com helep well well to improve di electricity challenge for di kontry.
Dele Momodu don tori say him hope say Senator Adams Oshiomole go apology to Obaseki
Dele Momodu tori for e instagram page say him go hope say Adams Oshiomole go apologize to Obaseki and e wife over di comment wey him make during di weekend wey make social media bi wan catch fire. For di video wey everybodi dey provoke put, pipo hear wen Oshiomhole tok say Obaseki and e wife no get children, and upon say dem nor get children, dem nor fit adopt becos say e bi like say dem nor like children even though both Obaseki and Betsy e wife don dey…
Police for Toronto don arrest di 9ja woman wey say she go kpai Edo and Yoruba pipo for Canada
Toronto police don tori for dia website say dem wan let di general public know say dem don arrest Amaka Patience Sonnberger, wey make wan hate incited speech say she go start to kpai Edo and Yoruba pipo wey dey Canada by putting okpor for dia food for her place of work. Dem tori say na on Sunday wey bi September 01, 2024, nai dem arrest Amaka for Toronto and dem com charge am say she use threat against certain pipo, police say, Amaka go appear for Ontario court of…
One native doctor for Edo state don kpai e client wey bi com do bulletproof okpor
Police don arrest one 19years old Timothy Dauda for Edo state, sake of say him shoot e client, kpai am as him dey wan test di bulletproof charm wey him do for di client. According to di tori, dis mata so happen for Onumu community inside Aoko Edo local gworment area for Edo state. Police informate com tori say, di native doctor know how to prepare charm for pipo against gun and cutlass, nai make dis e client wey him kpai so wey dem dey call Alex Ezekiel bi go…
New month new beginning
Today na di beginning of another month, dat means na new month, and di name of di month na September, wetin dat one mean be say, last month don pass and we nor go ever get August 2024 again, I mean like lai lai no more August 2024 except say we go now dey look forward to August 2025 wey we go see and celebrate by di grace of God. Now, I know say nor be everythin wey we plan to see happen, like nor bi all our desire for…
Minister of aviation don tell investors to report any aviation official wey go ask for bribe
Nigeria aviation minister, Festus Keyamo don ask investors to report any official wey go demand for any bribe before dem allow dem investors do business for 9ja. Oga Festus Keyamo tori dis mata for Washington wen e sidon with Boeing aircraft manufacturers executive and oda investors. Him com further address di ogas dem for di meeting say Nigeria door dey wide open for new business, and nothing go frustrate dem if dem com, and if any official try to frustrate dem dey ask for bribe, make dem make sure say…
INEC say na more dan 5000 BVAS machine dem wan use for Edo state election
Independent National Electoral Commission INEC, don tori say dem ready to put for ground more than 5000 Bimodal Voters Accreditation Systems Machines wey we dey call BVAS for di Edo state election wey go shele on September 21st, 2024. Dem com still tori say dem go ensure say di election go go smoothly across all 4,519 polling units and 211 collation centers across di state, as dem tori join say di configuration and installation of di BVAS machine wey dem wan deploy don already complete.
Na cement dealers dey frustration price of cement for we kontri-BUA
Chairman of BUA cement, Abdulsamad Rabiu don tori how cement dealers take frustration di plan wey him bi get to make cement price drop reach N3,500 for we kontri. The chairman of BUA cement com tori dis mata for dia 8th annual general meeting on Thursday, say all di effort wey dem make take reduce di cement price for consumers nor get way becos say dealers frustrate dat effort. and becos of dat dem nor come fit sustain and kontiniu dat policy to reduce price for consumers make e nor…