Edo state gworment don go commission 1-megawatt solar panel tins for di people of ohovbe wey dey Ikpoba Okha Local gworment area. Na Eng Godwins Omobayor wey bi di deputy gwornor nai commission dis project for di community. Tori kontiniu say di solar project supposed fit give about 2000 houses 24hrs light, dis na according to as di commissioner for mining and energy, Dr. Ojiefoh Enahoro take tori am during di event, him com further tok say dis solar mata wey go give 24hrs light to di community so, dey…
Blog
Police don invite NLC presido for questioning
Naija police don tori say dem don invite Joe Ajaero wey bi presido of Nigeria labor congress (NLC) for questioning because of some kurukere mata wey oyibo dey call criminal conspiracies. Dem com giv Joe Ajaero till Tuesday to report himself, odawise dem go issue warrant of arrest.
Kogi state gwornor don appoint 1192 special assistants
Usman Ododo wey bi di Kogi state gwornor, don tori say im don appoint 1,192 special assistants as aides. Na di secretary of di state gworment Dr Folashade Ayoade, nai tori dis mata give di people. According to di tori, dis borku special assistants appointment plus other ones go take alacrity from September 1st, 2024.
One community for Kebbi state don cry out say dem nid clean water
Di people of Yauri local gworment area for inside Kebbi state, don cry out say disease wan finish dem because of di yeye water wey dem dey drink and use take dey do every day tins. Dem say dis mata don dey happen for almost 30 years now, and yet dem nor even sure weder help go come anytime soon. Dem say di people of Yauri wey dey suffer dis water problem so, don sign petition give INEC, di commission wey dey in charge of election mata for Nigeria, and…
Police don tori say one man wey bi dey do 19 days fasting don kpai
Nigeria police don com tori say one 58 years old man for Lagos state wey bi dey do 19 days fasting don kpai. Dem tori say dis mata so happen on Monday for Alagbado area, and according to police, di man younger brother confirm say di man bi dey do 19 days dry fasting and na in di midst of di fasting nai him com kpai, so derefore dem nor suspect any kurukere doings except say dem go let di family prepare for di burial as dem ask.
Appeal court don direct former gwornor Yahaya Bello to report himself
Appeal court wey sidon gidigba for Abuja don give order to Yahaya Bello wey bi former gwornor of Kogi state to report himself with immediate alacrity for prosecution. No forget say di former gwornor bi pianteh since dat time wey EFCC, di commission wey dey prosecution any gworment official wey dem fit say e choplate di money dem supposed take work for dia state bi go raid am for e Abuja house, sake of say him get case to answer. Tori say since dat time after di raid nai dem…
Appeal court don tori say Philip Shaibu remains di deputy gwornor.
Appeal court for Abuja don tori say Philip Shaibu still remain di deputy gwornor of Edo state, dem tori say di first judgement wey Justice James Omotosho of federal high court first tok still remain, and base on dat them com dismiss di appeal wey Edo state house of Assembly file. Di court com tori further say dem still maintain say di way dem take impeach Philip Shaibu show say dem violate di constitution. Dem com later give directive say make dem pay Philip Shaibu e salary starting from April…
Presido Tinubu don warn say any official wey no get reason make e nor enta UN Assembly
Presido Tinubu don issue beta warning give gworment officials say make any of dem wey nor get any business to do for di United Nations General Assembly meetings nor step dia foot enter America where di meeting go for shele for September. Na chief of staff, Femi Gbajabiamila, nai tori dis presido warning give heads of government agencies for di one-day retreat wey dem organize for state house on Saturday. Him com further tori say di reason for dis presido warning na di step wey di renewed hope administration dey…
Try to think pass only yourself
One parable tok am say for dis life, anybody wey be say na only diaself dem dey think about without even considering say people dey around dem, say dat person nor supposed to first even dey here. Dat oda word com still tori am say, nobody be island for dis life, even di island self surround eself with some water in case of incasisi 🤣🤣 as dem tok. So, as you dey start your day today, especially dis beautiful Sunday, ask yourself weder na only you you nai you dey…
INEC don give voters for Edo state 8 days to collect dia PVC
Di Independent National Electoral Commission INEC don set 8 days aside for voters for Edo state to collect dia PVC wey bi permanent voters card wey dem go use take vote for di gwornorship election wey go shele for September 21 ,2024. Di commission come advise di voters wey register to com by diaself to come collect dia PVC card as nobody go collect on behalf of anybody.