NIN matter,Nigerians for abroad don appeal to CBN to remember them

Nigerians for abroad don lament say CBN wey be central bank of Nigeria nor carry dem along on top d NIN linkage matter. Na Clement Osuya wey be d presido of d world united consumer organization nai tori dis mata for one interview, im talk say CBN nor even give any direction on d way forward for Nigerians wey dey d abroad on how dem go take waka for d linkage of d NIN wey CBN say d deadline nah March 1st 2024 wey don already pass. Osuya com beg…

Minister of interior don tell Nigerians for abroad say the sweet experience im promise don land

D minister of interior, Tunji Olubunmi-Ojo, don tori am for im X handle today to Nigerians wey dey d abroad say, d sweet experience wey im promise dem regarding d softness to get new or renew their international passport don com. Minister Ojo say Nigerians abroad go com fit dey apply for their passport from inside their house. And to do dis one, u go need to visit d website to apply as u dey see am for d picture. We just wan troway salute to d minster for bringing…

D future of our youth dey Nigeria

D president of Africa development bank (AFDB) Dr. Akinwunmi Adesina don tok say d future of our youth nor dey d land of any other country but instead na Nigeria here nai dat future dey. Dr. Akinwunmi tok dis one during d 2023 Awolowo leadership prize ceremony where dem for give im d award. Dr Akinwunmi com advised say instead of make d youth dey choose to japa, wey nor dey bring about better development, make we d youth take pride in wetin we get as per d youth power…