Di earlier wey we realize say na only one life nai we get, and dis one life no come get duplicate, di more careful all of us go like to do tins. Prayers get e place, doing di right tin get e place, following rules and regulations get e place. You nor go neglect di rules and regulations wey dem put for ground com tok for your mind say God dey, becos according to you, you don already pray. E go com mean say you dey test God be dat,…
Category: Start Your Day
Forget di Past
One of di easiest tin to do na to sidon, put your hand for your jaw, and begin to wallow for wetin don already pass. Now, di reason why you nor suppose to at dis time put your hand for jaw and dey wallow over wetin don already pass, na becos say wetin don pass don already pass, and no amount of say you put your hand for your jaw go help gather any tablespoon of milk wey don already troway for ground. Di best thing to do nah to…
What are your daily thoughts
I just wan remind you say thoughts dey very powerful, nai make every of your thoughts, negative or positive get di way e take dey shape your life. But di good thing be say, no mata how your thoughts dey go, meaning if you dey always dey think negative thoughts, dis na di time to change and if you dey on di lane of always thinking positively, kotiniu to improve on that positive thoughts even when you think say you never see results. As you start your day, take time…
Follow your dream
Dis dream, wetin e be sef? Dream get many features or definition, but most importantly we fit define dream as that aspiration, that ambition or that idea wey you dey cherish well well, so that your aspiration, ambition and that idea wey you dey always think about fit turn out to be di dream wey nature bless you with as you dey come dis world. Now di question be say, why e be say most of us nor dey follow our dream? According to di late Dr. Myles Munroe, him…
What are you doing with your time
Seconds nai dey turn to minutes and minutes go turn to hours while hours go eventually become full day, nai make am be twenty four hours make one day. Now di question be say, wetin you dey do with your seconds, your minute, your hours, and eventually your time?. For some of us, di time dey do tik tok without anything to show for am, for some we dey wait for di perfect time before we take any steps towards wetin we plan to do for life; but di good…
You dey wait for di right moment?
Di holy book say, any body wey dey look weather nor go sow, and if you nor sow, you nor go reap. Now dis sentence up dere suppose be everybody handbook on a daily basis; that is, if you wan do anything, and you dey wait for di right moment, e mean say u go fit just wait tire, because d right moment nor go ever come. So today, if you get anything wey you dey keep dey wait for di right moment to come, my dear, na now wey…
Indecision
First of all, wetin be dis indecision sef? indecision simply mean say di person lack di ability to make decision or nor dey fit make quick decision. If you don ever go through di consequences and pains of indecision before, you nor go wan stay day lane again. Most of di stress wey we dey go through, nah di result of di decision wey we nor gree take. So today, take di time, analyze which part of your life wey your indecision dey affect right now, and do one thing;…
Concentrate on what you want
I don find out say, if you concentrate on wetin you want and dey think less about wetin never work, wetin you concentrate, focus and channel your energy put, go just dey find way to happen and work eventually. So today as you start your day, try to concentrate and focus more on wetin you want. Have a beautiful day.
Think Twice
Sometimes, if we go just use small time take think twice about any situation wey happen, we go discover say we for nor take di action wey we take regarding dat situation. I don discover say, di small time wey we dey use take think twice before we take any action, go save us from so many trouble and regret. So, as you dey start your day, incase any mata or situation happen, just remember say you read for somewhere say, no mata wetin happen, make you use small time…
D solutions dey always dey inside di problem
As you dey start your day, I wan make you know say most of di time, if you sidon look well, you go discover say d solution wey you dey look for dey inside di problem. So no mata how bad di problem be, just take time take sidon, and den figure out d solution small small from dere. Have a beautiful day.