Dem don arrest some chinese pipo wey dey do illegal mining for Nasarawa

Ogbonge security pipo from di mining marshalls of di Nigerian Security and Civil Defence Corps (NSCDC) don arrest four chinco pipo becos of illegal mining wey dem dey do for Nasarawa State. Nor forger say illegal mining don carry Nigeria as a kontri go back well well, as dese illegal miners go mine finish, dem nor go pay any tax to our gworment or even say make dem repair di community wey dem for dey do di illegal mining, but dem go scata everywhere finish, and den carri di plenty…

American international suku say dem don return di aduvance fees wey Yahaya Bello pay for im children

Di American international suku wey dey Abuja, where former guvnor Yahaya Bello for go pay aduvance fees for im children don return $760,910 to EFCC. Na di head of di suku Greg Hughes, nai tori dis one on Saturday, say di suku nor get nortin to hide for di mata, say dem agree say dem collect di aduvance fee, but as dem com learn say di aduvance fee dey in connection with di mata wey EFCC dey investigate, dem begin cooperate with EFCC and com return di amount to EFCC.…

Lagos state gworment don tori say Sanwo-Olu nor talk say new minimum wage na N70K

Lagos State gworment don tori say e nor get di time wey govnor Babajide Sanwo-Olu take tok say im don increase minimum wage to N70,000. Na Lagos state commissioner for information nai tori dis one say, di tori wey dey out dere say guvnor Sanwo- Olu increase minimum wage nor correct, say di guvnor only tori say since January, civil servants don dey earn N35,000 as wage award wey federal gworment say make workers dey reciv, and if you add dat N35,000 wage award join di N35,000 wey civil servants…

New minimum wage for workers fit nor happen on May 1st

Presido of Trade Union Congress of Nigeria (TUC) Mr. Festus Osifo, don tori say, di new minimum wage wey every worker tanda and dey scratch ear dey wait for fit nor happen on May 1st. Festus Osifo tori dis mata for Abuja as im dey address newsmen, im com say, di reason why di new minimum wage nor go fit ready on May 1st na becos say di committee wey sidon on top di mata of di increase still dey do deir work and im believe say soon all of…

Tinubu don appoint Jim Ovia as chairman of Nigeria Education Loan Fund

Presido of Nigeria, Bola Tinubu, don appoint Mr. Jim Ovia as di new chairman wey go head di board of di Nigerian Education Loan Fund (NELFUND). Jim Ovia na ogbonge better banker and better business man, and na Friday nai presido appoint am, as Ajuri Ngelale wey bi di special adviser to presido on media and publicity mata take announce am. Presido tori say, di education loan fund need person wey be professional and com get experience join, and im believe say Jim ovia go use e experience and professionalism…

Tinubu don approve N100billion as consumer credit for Nigerians

President Bola Tinubu don approve make dem start di N100 billion consumer credit scheme for Nigerians becos of di economic hardship wey dey kontri. Na Ajuri Ngelale, wey bi di spokesperson to presido nai tori dis one on Wednesday. Im com tok say any Nigerians wey dey interested fit visit di portal of Nigerian consumer credit corporation before May 15, 2024. dis na di portal wey di spokesperson say make working Nigerians visit if dem dey interested. “Working Nigerians interested in receiving consumer credit can visit www.credicorp.ng to express interest.…

Concerning di fire mata wey happen for Bini

Tori tok say fire don happen for mostly medical shops wey dey opposite university of Benin teaching hospital (UBTH). Dem say na one of di shop nai di fire for start before e com spread enter oda shops for dere, and as di fire start, both di federal fire service, di Edo state fire service, di Nigerian Army school of supply and transport Benin, di University of Benin fire service, and di University of Benin Teaching Hospital, UBTH, com try dier best to make sure say dem fit quench di…

Peter Obi don reply Reno Omokri about di school mata

Mr. Peter Obi, wey bi di presidential candidates of Labour Party LP for di last general election wey happen for 2023, don com tori why im nor build new schools when im be govnor for Anambra State. Peter Obi tori dis one wen im hold one press conference on Wednesday for Abuja. Na dere Obi com reply Reno Omokri wey be social media influencer wey say im challenge anybody to show school wey di former govnor build for Anambra state di time wey im be govnor, Reno com say im…