Rivers govt don tori say dem go support federal gworment for di housing plan

Rivers state govnor Sir Siminalayi Fubara don tok say im administration go support di housing plan wey federal gworment get for Nigerians. Sir Fubara tori dis one on Wednesday as im reciv di MD of federal housing authority Hon. Oyetunde Ojo and e team. Di govnor com further tori say dis housing project wey federal gworment plan, go reduce di housing challenge wey both low and medium income earners dey face for di country, and di plan dey in line with deir own plan as dem don plan on how…

NANS say dem support Air Peace

Di National Association of Nigerian student (NANS) don tori say dem support Air peace, becos dem see am say Air Peace na national asset and achievement wey go promote economic growth. Na di NANS senate president, comrade Akinteye Babatunde nai tori dis mata on how the change wey Air Peace bring com di market don take help di average Nigerians. Di comrade com further tori say make Nigerians do everytin to rally round and make sure say Air Peace succeed.

Sanwon Olu say more buildings must demolish

Govnor of Lagos state, Babajide Sanwon-Olu, don tok say dem go nid to scatter more building for di dosumu market area, so dat dem go fit clean up due to di fire wahala wey happen. Sanwon Olu tori dis mata on Thursday wen im and some members of di executive visit di area. Di govnor announce earlier say, di market all round go close until dem finish di full assessment of how di fire take start. Sanwan Olu com further tori say, since people no like to do di right…

Alex Otti say im support Presido housing plan

Alex Otti wey be di govnor of Abia state don tori say im government go support presido Tinubu’s vision for di affordable houses wey im plan for Nigerians. Govnor Alex Otti tori dis one wen im receive di people of Federal Housing Authority wey di MD, Hon. Oyetunde Ojo carry com Abia state. Na dere Alex Otti tori further say, di vision of dat house mata dey in line with e own gworment, say im gworment don already site location to build diaspora village, so derefore im gworment go support…

Di people of Rafin Duma village need ballot box development

Di people of Rafin Duma village for Gada Local Goverment Area for Sokoto state don cry out becos of di suffer wey dem dey suffer before dem get ordinary drinking water. According to Mallam Jabir Ibrahim Yaro, wey wedipeople reach out to, after him post di mata for him X handle, come tori say di situation dey very critical as you can see for di video wey Mallam share give wedipeople. Mallam Yaro wey dey try to see how him go take get help for dis Rafin Duma community, come…

Wetin dey happen for cooking gas lane

Di price of cooking gas wey dem still dey call liquefied petroleum gas, LPG, don increase from N10,323 to N14,150 for 12.5kg cyclinder. Dem still dey maintain say na di increase of foreign exchange nai make di price go up like that. But most of we di people don complain say, dem don already start to dey use fire wood as e be say dem nor get money to buy gas becos of di increase.

Philip Shaibu vows to fight on

Philip Shaibu wey di state house of assembly just impeached on Monday as deputy governor don vow to fight on. Philip com describe di impeachment as illegal and witch hunting, say nah because of di ambition wey him get to contest di governorship election of di state under di People Democratic Party (PDP) nai make dem cook up allegations against him, and him go fight di impeachment. Shaibu com tok say di illegal impeachment as im describe am na heavy blow to democracy and di rule of law. Di former…

Omobayo Godwins don replace Philip Shaibu as deputy governor of Edo state

Godwin Obaseki wey be governor of Edo state don pick Omobayo Godwins as him deputy after di state house of assembly impeach Philip Shaibu. Di chief Judge, Justice Daniel Iyobosa Okungbowa nai swear Omoboya in as deputy governor on Monday. Remember say dem impeach Philip Shaibu on di grounds of misconduct say him commit perjury base on say he allegedly leak government secret.