Edo state house of assembly don finally impeach Philip Shaibu wey be di deputy governor of di state. Di house of assembly com impeach di deputy governor on Monday after dem adopt di report of di seven member probe panel wey dem set up to probe di allegation of gross misconduct against Philip Shaibu di deputy governor. Di assembly com tok say Philip Shaibu offence dey impeachable as dem accuse am say him commit perjury due to say him leak state government secret.
Category: We DI People
No more searching of citizen’s phone- Nigerian Police
Di Edo state command of di Nigeria Police don ban officers wey dey on patrol routine from searching of we di people, citizens phones. Na di state police spokesman SP Chidi Nwabuzor nai tori dis banning tori for di statement wey him issued on Friday. According to SP Chidi, wey tori say di Edo state commissioner of police, CP Funsho Adegboye, don advise officers and other men to stop to dey search citizen’s phones going forward, and dis instruction dey com from di inspector general of police, IGP Kayode Egbetokun.…
Tinubu don sign student loan amendment bill into law
President Bola Tinubu don sign di student loans wey be (Access to Higher Education) Act (Repeal and Re-Enactment) Bill, 2024, into law. Dis na after di senate don finish to debate on di bill. Di purpose for dis bill na to give poor Nigerians access to higher education through interest-free loans from di Nigerian Education Loan Fund, wey the Act established to make sure say every Nigeria no mata your background fit afford to go school. But public opinion com tori say di pudding dey inside di choplation, and we…
President Tinubu say inflation go com down
President Tinubu don assure we di people say di economy don dey breathe small small and inflation go come down very soon. Presido yarn dis tory when him dey address di members of di presidential campaign council of di All progressive congress(APC) for state house banquet hall for Abuja. Presido com tori more say, him know say e job hard nor be small, and nor be magic to fix di issues wey dey confront Nigeria, but since him campaign promise Nigeria good result, him go continue to work to fulfill…
Dem say make vigilante as gworment workers dey wear ID card for Benin
One of our brother don share one video from gossip mill after vigilante group for Benin city Edo state tell another of our brother say make him come down from inside commercial bus say them wan check e bag. Na there di boy start to dey para and begin ask make di vigilante people show their ID card to prove say dem nor bi fake vigilante and fake gworment worker, and for di video we nor see say di vigilante people dey make any attempt to show our brother their…
Senate don pass student loan bill
Di Senate don pass di student loan, Access to higher Education, Act 2024. Dis Bill go provide easy access to higher education for indigent Nigerians with interest-free loans from di Nigerian Education loan fund, wey dey inside di Act to provide education for all Nigerians.
Court don dismiss Adventist church suit wey dem file to stop election and exams on Saturdays
Justice James Kolawole Omotosho of di federal high court for Abuja, don dismiss di lawsuit wey one member of Seventh Day Adventist Church of Nigeria, Ugochukwu Uchenwa file to stop elections and exams to dey hold on Saturdays for we country. Di member been carry dis mata go for court because say nah Saturdays nai dem take dey hold service. But di court com described di case wey Ugochukwu file against di government as “frivolous, vexatious, bothersome, and unjustified.” Di judge come further tori say di Seventh day Adventist church…
Abia Assembly don pass bill to stop pension for ex-governors and their deputies
Abia House of Assembly don finally pass one bill on Tuesday, and di bill na to stop di payment of pensions to former governors and their deputies for di state. And dem com title d bill wey Mr Uchanna Okoro, majority Leader and member representing Arochukwu state constituency sponsor. “A Bill (H.A.B 11:) for a Law to Revoke The Abia State Governors and Deputy Governors Pensions Law No 4 of 2001 and for other Matters connected in addition to that.” Di speaker of d house, Mr Emmanuel Emeruwa com tori…
LASTMA don charge 14 of their officers with corruption and misconduct
Di Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) don find 14 of their officers guilty of corruption and misconduct wey happen when dem dey perform their duties, and dis misconduct and corruption dey happen since four months ago. Na Olalekan Bakare-Oki wey be LASTMA general manager, nai tori dis mata for im interview with di News Agency of Nigeria (NAN) on Tuesday for Lagos. Bakare-Oki tok say, since im resume office on November 20, 2023, 18 officers don face authority personnel management board over misconducts, and dem com find 14 guilty,…
FAAC share di sum of N2.07 Trillion for February to di three tiers of government from January revenue wey dem generate
Di federal account allocation committee don share N2.07 trillion from di total revenue wey dem generate for January 2024 to di three tiers of government of di country. According to Rufai Oseni X handle, wey im for share breakdown of di amount different state receive, and asked citizens of eah state to hold their government accountable. Dis na di breakdown of wetin your state receive. ABIA: 8.3BNADAMAWA: 8.4BNANAMBRA: 10.1BNBAUCHI: 8.3BNBAYELSA: 22.8BN BENUE: 9.7BN BORNO: 10.5BN CROSS RIVER: 6.6BNDELTA: 38.1BNEBONYI: 7.3BNEDO: 10.2BNEKITI: 6.9BN ENUGU: 8.5BN GOMBE: 7.1BN IMO: 9.5BN JIGAWA: 9.8BNKADUNA:…