NANS don ask for probe of d mismanagement of Ajaokuta steel

D National association of Nigerian student, NANS, don tok say make dem probe d way people take mismanaged money for Ajaokuta steel company and d national iron ore company wey dey kogi state. D association through deir president Lucky Emenofe com accused some official for d past government under Buhari, say dem mismanaged a whole $496 million as e concern d Ajaokuta steel. Lucky Emenofe come tori for im statement say, dem thank presido of d country for d way e dey try to make sure say d company work,…

10 suspected dealers for illegal petroleum products don enter EFCC net

D Economic and financial crimes commission EFCC for Uyo Akwa Ibom state, don dey investigate 10 suspects wey dey deal on illegal petroleum product without d correct license. Na Mr. Dele Oyewale wey be d head of media and publicity for d commission, nai tok dis mata for one statement yesterday. According to Mr. Dele, na d Nigerian navy forward operating base nai catch dem with their ship and come handover dem give EFCC. D Navy handing over officer, Captain Uche Aneke, com tok say dem go continue to dey…

Civil society council don beg presido to appointment new humanitarian minister

D national civil society council of Nigeria (NCSCN), don beg presido make e take am as quick mata to appoint new minister wey go dey in charge of activities for d humanitarian ministry. Remember say president Tinubu sack Beta Edu wey be d former minister for humanitarian affairs and poverty alleviation becus of d plenty wahala of mismanagement and money wey dem transfer to d wrong accounts, and since that time d ministry never get any minister. D civil society council com tok say d mata wey happen d last…

FG don talk say health workers must resign their appointment before dem japa

D minister of state for health, Dr. Tunji Alausa, don tok on Saturday say federal government don give direction say any health worker wey dey plan to pack go d abroad wey we don know as japa dese days must resign deir appointments before dem japa. Dr Alausa com tori dis one when im visit d Neuro-Psychiatric hospital, Aro, for Abeokuta, Ogun State. D minister tori say no more leave of absence as dem dey do am before, and dis order dey among d executive order wey presido sign as…

Police don rescue 16 pregnant girls and eight babies inside one baby factory for Abia state

Abia state police command don catch baby factory for Aba, and dem don rescue 16 pregnant women plus eight pikins, wey be five boys and three girls, during d operation wey dem carry out on Thursday evening. One police officer from d rapid response squad wey dem for parade d women on Friday, com tok say dem rescue d women based on d information wey d people wey dey around give dem. D rapid response squad officer tok say, d building wey all dis for happen so, na for one…

Tony Elemule don advised federal government to privatize transmission lines

D chairman of transnational corporation (Transcorp) and united bank of Africa (UBA) don advise government to change d power sector, and make dem also privatize transmission lines wey go help d economy grow, as e be say d economy just dey struggle. Na for d interview wey im sidon with Bloomberg na him for tok say d wahala wey dey d electricity market nor make any industry grow becus of poor production. Oga Tony com tori more say nor be good tin say Nigerians still dey depend on generator dis…

Federal govt don tok say repayment of student loan na 2 years after youth service

Federal government don tok say people wey benefit from d Nigerian education loan, go get two years after dem serve youth service finish to pay back. Na d executive secretary of NELFund, Dr. Akintunde Sawyer, nai tori dis for d interview with News Agency of Nigeria for Abuja. E tory say d reason for d two year grace after youth service na to give all beneficiaries borku time to get work, and den repay d loan after dem stabilize. Him com further tori say dem nor go still put pressure…

Man don beat e wife die for Rivers state

Tori tok am say one man wey get three pikin wey dem dey call Michael Chiozie for Rivers state don beat e wife and kpai am on top house rent mata. . Dem say d suspect kpai e wife wey her name be Ufuoma Chidozie on Tuesday for Mile 4 area for Port Harcourt. D police public relations officer of d state command, Grace Iringe-Koko com tok yesterday say dem don arrest d suspect wey be Michael Chidozie and don hold am on top d mata say e beat e…

Government don open one new satellite pay Tv

Federal government on thursday for Abuja com launch one new satellite pay television wey dem tok say go give Nigerians better service for their money. Na George Akume wey be d secretary to d government of d federation wey e senior special assistant Prof. Babatunde Bernand represent, nai com open dis Nigerian satellite television wey happen for d shehu Yar’Adua center for Abuja. Congratulations Nigerians.