D minister of finance and coordinating minister of economy Wale Edun don tori senate committee on finance on wednesday say na d N22.7tn wey central bank of Nigeria tru d ways and means overdraft for government under Buhari from 2015-2023 nai land Nigeria for d heavy inflation wey d country dey face now. Oga minister com tok say dem just print money anyhow and spend am anyhow, and dem nor com make any effort to put d reckless spending side by side with productivity. but d senate com tok say…
Category: We DI People
Court don talk say Abure remain Labour party’s chairman
D court of appeal for Abuja don tori say Julius Abure remain chairman of Labour party. Justice Harma Barka wey deliver dis judgement come tok say mata wey dem bring against d chairman and others wey dem accused, na mata wey don pass before d election wey we dey call pre election matas and na also internal affairs mata wey nor suppose to even come court of appeal. D court come also tok say d people nor fit prove d allegation wey dem accused dem for.
Federal government don talk say dem go collect discos license back
Federal government com tori on wednesday say dem go withdraw all d licence wey dem give discos since dem nor dey gree supply light wey dey cause black out round we country. Minister of power chief Adebayo Adelabu nai tori dis mata for im X handle say despite effort from FG, some of dis power distribution company dey purposely nor dey wan give people light. Oga minister com still tori say as from now on, im go hold all of dem wey no wan dey supply light responsible including to…
Edo state house of assembly don tok say dem go impeach deputy governor Philip Shaibu
Law makers for Edo state come tok on wednesday say dem go impeach deputy governor Philip Shaibu sake of say e be like say e come go tori some kind mata wey concern d government for outside. But some people like d conference of registered political parties for Edo state com tok say dem no support d impeachment wey be like say dem start on March 5th and 21 members of d house don already sign am. Nor forget say nah last week nai Philip go d national secretariat of…
President Tinubu don sign executive orders wey go reform oil andd gas sector
Nigerian presido, Bola Tinubu, on Wednesday com sign three executive orders on top d oil and gas sector to bring fiscal incentives for related projects, reduce costs and time wey dem dey take do contract, and promote cost efficiency for local content requirements. One statement from d special adviser to d presido on top media and publicity, Ajuri Ngelale, come tok say d policy directive wey presido give na to improve d investment environment and make Nigeria be d preferred place for investors wey dey eye d oil and gas…
President say dem don attract $30bn direct investment
President Bola Tinubu talk say im administration wey never reach one year don attract $30 billion direct foreign investment commitments to help boost d Nigerian economy. Tinubu tori dis one for d 2023 Leadership annual conference and award for Abuja. D event, wey get d theme “An Economy in Distress: The Way Forward”, wey d Leadership Group of Leadership Newspapers organized. Tinubu, wey d minister of Information and national orientation, Alhaji Mohammed Idris represent for d event , tok say Nigerian economy no dey inside wahala, but e dey face…
PDP don talk say dem go dey wait for Philip Shuaibu wey be Edo state deputy governor for court
D Peoples Democratic Party (PDP) don tori say dem legal team dey wait for Deputy Governor of Edo State, Philip Shuaibu for court over d mata of d party primary election wey happun for d state. Na d deputy national publicity secretary of PDP, Ibrahim Abdullahi, nai tori dis one, and add say d party no dey shake for d deputy governor threat to carry d mata go court to declare am as d authentic PDP candidate ahead of d state governorship election wey dey come for September. Abdullahi tori…
EFCC don catch 21 trucks wey be wan thief our food go Cameroun and nearby countries
EFCC operatives for Maiduguri zonal command don catch 21 trucks wey full with food and other things. D anti-corruption agency tori say d trucks dey waka go N’djamena, Chad Republic, Central African Republic, and Cameroon. D agency tori say dem intercept d trucks for major road junctions for Kalabiri/Gamboru Ngala and Bama roads for Borno State. D agency tori say dem see food items wey dem hide inside d trucks, but dem catch am because their eye dey shine like eagle. Dem talk say dem check d papers wey cover…
Wike don set up FCT civil service commission
D minister for federal capital territory Nyesom Wike don announce on monday say im go set up civil service commission for capital territory. Na d meeting wey im hold with directors of FCTA and d Federal capital development authority FCDA nai im for tori dis one, im come still tori say d commission go appoint nine permanent secretaries to handle secretariats. Oga minster Wike come tori say d secretariats na transport and economic planning, agriculture and rural development, revenue generation and public private partnership, education, social development, legal services ,area…
Obi say e dey painful say na Ukraine come dey donate food give Nigeria.
D presidential candidate of Labour party for d 2023 general elections Peter Obi, don tori say, e dey very painful say na Ukraine wey dey fight war with Russia nai come dey donate food give Nigeria. Him tori say even though d food donations good, but e still go to show how d government of d day don fail to take care of e people. Peter Obi tori for am for im X handle say, d mata come dey be like national disgrace sake of say Nigeria wey God bless…