D chairman of Nation drug and law enforcement agency NDLEA rtd General Mohammed Marwa, don advise parents to dey shine their eye for their children body because of d so many drug abuse mata for d country. Him tori say make parents dey try to give better care to their children sake of say this fit help prevent d drug abuse wahala. D oga tori dis mata for d ramadan lecture wey d Alhaji Mohammed Lawal memorial jummat mosque, Asokoro, Abuja organize. E tori say d prevention efforts wey dem…
Category: We DI People
Buhari leave poor economy for Tinubu- Muftwang
D Governor of Plateau State, Caleb Mutfwang don tori say na Buhari administration nai cause d hardship wey Nigerians dey face right now. Him tori dis one on monday when im dey swear in 22 special advisers and heads of government agencies for government house Jos. D governor come talk say dem sell Nigeria future under d last administration wey dey under Buhari sotey dem print a whole 30 trillion naira and just share am. D governor come continue to tori say e owe d people d truth even though…
Idahosa say na him be authentic APC governorship candidate for Edo state
Dennis Idahosa of APC don write to d chairman of Independent national electoral commission INEC say make e no accept d name of any other candidate becus say na him win d governorship primary election wey dem hold on February 17th 2024. Nor forget say dem later declare d primary election inconclusive and come hold another supplementary election where d party for come declare Sen. Monday Okpebholo d winner of d APC primary election. Dennis tori for e letter say, na him win d February 17th 2024 primary election wey…
President Tinubu don return to Abuja from d Qatar waka
Vice president Kashim Shettima plus other government officials don welcome d president from e Qatar waka. Tinubu return on monday to Abuja after d two days visit to Qatar where im for sign some agreement on some sectors like education and others with Qatar.
Navy don arrest one ghana vessel wey thief two million litre of our oil
Navy under operation Delta sanity don hold one vessel wey belong to Ghana but get just one Ghana member and 12 Nigerians inside, and dem hold dem becus say dem thief our oil wey reach about 2 million litre. Na d director of information Navy, Rear Adm. Adedotun Ayo-Vaughan, nai tori dis one on monday for Abuja. D director tori say d ship off their automatic identification system so dat nobody go fit catch dem as dem be dey waka dey go Benin Republic. E come tori say dem go…
Governor Obaseki of Edo state don advise say d way forward nah to focus on d fundamentals
Governor of Edo state, Godwin Obaseki don advise say d way forward from wetin d country dey face right now na to focus on d fundamentals, and dat fundamentals go be to increase production instead of to dey increase interest rates as CBN just do am recently. Him tori dis one during d annual Edo zone bankers committee dinner wey dem hold for Benin city wey be d state capital. D governor come tori further say d next few months fit get as e be if small business nor fit…
Inspector general of police don ban POS operators for police station for d whole country
D inspector general of police, Kayode Egbetokun, don ban operators of point of sale wey we know as POS and other electronic mobile money transaction devices comot from police station and police facilities round d country. Oga IGP tori dis mata on monday say d ban dey necessary at dis time becos of d wayo transaction of POS machine operators with some police officers for we country. ACP Olumuyiwa Adejobi wey be d police public relation officer come further tori d mata say d directive from IGP na to preserve…
Ukraine don donate 25,000 tons of grains give north east Naija
D United nations world food program (WFP) don thank d government of Ukraine for their kind donation of 25,000 tons of wheat wey go help give emergency food support to almost 1.3 million people wey dey affected for northeast Nigeria. Na Atinuke Akande-Alegbe wey be senior communications and public diplomacy officer of d British high commission for Abuja nai tori dis mata on Thursday. Dem talk say dis important contribution na part of Ukraine’s humanitarian grain from Ukraine initiative wey President Volodymyr Zelenskyy launch. Dem add say d arrival of…
Reps don ask private airline operator to give account of d covid-19 relief funds
D house of representatives public accounts committee don give private airline operators for Naija one-week deadline to explain how dem take use d N4bn wey federal government give dem to fight COVID-19 or make dem refund d money if dem no fit provide evidence on how dem take spend am. D committee wey Bamidele Salam, one member of d Peoples Democratic Party from Osun State wey be d chairman nai give d ultimatum on friday for d resumed investigative hearing on top d mata wey concern mismanagement of COVID-19 relief…
Senate don talk say dem go probe d N30tn loans
Nigeria senate don talk am say dem go start to question some central bank officials on how dem take give out and d spending wey surround d 30 trillion naira loan for ways and means wey federal government collect during former president Buhari. Na d chairman of d senate ad-hoc committee senator Isah Jibrin nai tori dis mata for one of e tori, e come tori say d probe go start this week. D senate tori last week say dem go probe how dem take spend d money because d…