Vice President Kashim Shettima don tori say nah d pure heart wey president Tinubu get nai make God reward am to become Nigeria president. Shettima come tori dis one on friday, March 1 wen im host some we d people of d Nigerian Christian Pilgrim Commission (NCPC) wey come visit am for Presidential Villa, Abuja. ”Him come yan say d road wey carry im Tinubu reach presidency no be by chance, say apart from im pure heart Tinubu ready to sacrifice for d betterment of d nation. Oga VP come…
Category: We DI People
Tori don talk say inmate for jos area don dey protest because of say dem wan ration deir food due to hardship
D protest wey dey happun sake of d hunger wey dey rise for Nigeria, don enta another level on Friday as inmates kpokpo for d Nigerian Correctional Centre wey people know as prison for Jos, wey be di capital of plateau state don join d protest. D inmates start to protest as soon as dem hear sey dem wan ration d amount of food wey dem dey give dem. As d protest dey happun, d inmates no gree follow d orders wey d officers give dem and dem no come…
Labour leaders don reply Tinubu make him focus on d hardship for d country instead of 2027
Nigeria Labour Congress (NLC) don yab President Bola Tinubu because of im comment on top d protest wey d union do for Tuesday wey im call “unacceptable”. For one press statement wey NLC president, Joe Ajaero release on Friday, e tell d president make e use im energy solve d many wahala wey dey worry Nigerians, and make e no dey yarn grammar with labour people wey get d right to protest. Dem come still tory say make president focus on d promises im make to Nigerians. No forget say…
Kaduna residents come weleh BUA truck and carry plenty carton of their noodles wey be indomie run comot
Some pipo for Zaria for Kaduna State on Friday kon carry plenty cartoons of indomie comot from one truck wey dey move wey dey load foodstuffs wey belong to BUA company. One person wey be resident for di town tori am sey e happen for Dogarawa area of Zaria afta some youths dey para because say dem fit say d company dey among d manufacturers wey dey increase prices of dia goods without say dem no consider d no money for d average citizens. E tori say dem say dis…
President Tinubu don direct Dangote, BUA, and oda companies to go back to d old price of cement
President Bola Tinubu don direct all d cement companies for Nigeria to go back to old price of cement as e be before. Na d Minister of Works, Senator David Umahi tori am on Thursday after him inspect BUA cement factory for Sokoto State. D minister come tori say d new presidential order dey ask all d cement manufacturing companies to go back to d previous price for cement to help the economic hardship wey we d people dey face dis time around.
House of representatives don tori say dem want make secondary school student dey do drug test cos of too much abuse
House of representatives don tori say dem want federal ministry of education to collaborate with federal ministry of health so dat dem go come out with by force drug test program for secondary school students in Nigeria because of d too many drug abuse these days. Dem come still ask d national orientation agency and d national drug law enforcement agency (NDLEA) to increase d tori on abuse among our secondary school students round d country. Dem also tori d committees on basic education and services, and healthcare services to…
Nigeria custom service don kpake fake medicine wey be pharmaceutical product.
Custom service for Nigeria don tori say dem don kpake fake fake medicine wey reach almost 1.4 billion naira for around oyo and osun area command. Na d oyo-osun area controller, Dr Ben Oramalugo nai tori dis on Wednesday as e dey talk to tori tori people wey english dey call reporters, oga area controller come tori say d fake medicine nah mostly d one wey dem dey call antibiotics wey dem pack inside sack. Oga kpatakpata Oramalugo come tori say anybody wey dey carry fake medicine na enemy of…
Association of table water producers don tori say Nigerians fit start to buy one sachet water for N100
D association of table waters producers don tori during deir press conference say right now even though one sachet water dey sell for N50 we d people fit start to buy one sachet for N100. Dem come tori say cost of production dey cripple deir business and put dem into more debt. Dem say almost all of dem wey be producers dey either get money from outside source or dey borrow heavily. D association members come tori say abeg make Nigerians bear with dem as d situation come be for…
Tori say na only less dan 40% of people for Africa dey use internet
According to International Telecommunication Union wey be United Nations specialized agency and official source for global ICT statistics don tori say even doe access to internet connection dey increase round d whole world na only 37% of d population for Africa dey use internet. Tori say while about 90% of d population in Europe, d Commonwealth of Independent States and North and South Americas dey use internet, Africa as a continent come get d lowest internet access for d whole world with only 37%. D tori come still talk say…
Tori say yawa don dey gas between papa and pikin for Kogi state
Sahara reporter don tori say yawa don dey gas between current governor Ododo of Kogi state and d former governor Yahaya Bello because of 1200 bags of rice. Sahara don tori say silent yawa don dey go on since between d two leaders of the state. For more tori abeg visit https://saharareporters.com/