Philip Shuaibu don land PDP headquarters to demand certificate of return

Philip Shuaibu wey be deputy governor for Edo state don land for d headquarters of PDP to ask for certificate of return, because according to him, e say na him win d last primary governorship election wey PDP hold on February 22 2024. According to d governorship primary tori wey happen for Samuel Ogbemudia stadium for Benin, d chief returning officer come declare say nah Asue Ighodalo nai be d winner of d primary election after e win with 577 votes, base on dat win Asue Ighodalo come go collect…

Dem don detain some Binance executive because of crypto mata

Tori don talk say dem don detain two binance oga kpatakpata today because of d crypto wahala. Tori come say d two oga kpatakpata fly come Nigeria as dem here say Nigeria wan ban crypto currency. According to d tori, dem say officials never provide borku informate on why dem detain dem, say dem also block other platforms wey be forextime, octafx, crypto, fxtm coinbase, Kraken and others. The tori come continue say CBN governor Yemi Cardoso don dey worry say e be like say some kind kurukere market dey…

President don assure Nigerians say light must shine in the end

President Tinubu don assure Nigerians say no matter wetin dey happen now for we country say light must shine at the end. President come tori dis assurance when he tanda for d expatriate employment levy mata today, he come tori say with d kind people wey him put e place to manage d affairs of d economy say light must shine. We go only say make we d people continiu to pray for the president and e team because this light suppose shine.

Nigeria Labour congress NLC don suspend protest, come give ultimate

Nigeria Labour Congress wey be dey protest today don decide to cool small temper and suspend d nationwide protest for now, dem nor just suspend d protest, dem come give federal government ultimate wey dem say e go expire for March 13 2024 and dem want government to implementation d October 2 2023 agreement and other borku tori wey dey inside d letter wey dem present. According to d placard wey we d people see say some of d protesters carry nah say make government inside dis hardship support local…

Almost 20 student don kpai becos of meningitis for Yobe state

Daily Trust don dey tori say around 20 students don kpai for some boarding house school wey dey  Potiskum, Fika, and Fune local government areas for Yobe State.  Dem tori am say d kpai kpai so dey happen for government science technical college, government girls science technical college, and federal government girls college, and all of dem dey inside Potiskum. Dem come tori say other students wey d disease affect don dey respond to treatment for inside specialist hospital wey dey Potiskum. According to d tori wey dem tori say…

Court don jail two illegal bdc operate for kano state…

Tori don talk am say court for kano state don tell two men wey their name be Munkaila Sani and Mohammed Sani wey dey operate illegal bdc without license to go sidon for inside prison for one year. According to d informate wey EFCC informate for their long hand wey be former twitter, EFCC say d men come agree say dem guilty as charge after d man wey dey hit dat wood for table wey we dey call Judge tell dem say dem don break d law according to section 57 (5)…

Oronsaye report go come implement…

Federal government don tori we d people say d oronsaye report and recommendation wey him Mr. Oronsaye and e team bring come out since 2012 go come implement. President Tinubu don direct say make dem shine eye into d report and make sure say evry tin wey Oronsaye and e team talk for d report dem put am to action to make am shake body well well so that d plenty money wey dem dey waste for government go comot. We d people come hear with corner ear say according…

Youth Unemployment Benefits….

We D People, federal government don tori say e go stretch the catapult of social security payment to youth wey no get work for d country, nah after d execute meeting wey take place on monday nai d coordinating minister for we nation Wale Edun tori we d people, him come tori say dem go set up consumer credit scheme wey go help to cool down d wahala of d adjustment wey we d people dey face right now. Minister Wale Edun come still tori say when we d people…

Naira advocate

Our able senator, Senator Ned Nwoko wey dey represent we d people of Delta North don tori say make all the moni wey go dey exchange hands for the country be only naira and make dem ban am for dollars, say na becos of dollars nai make our ognonge beta naira come be like say e nor come get value. The husband of our beautiful nollywood actress wey be Regina Daniels tori this tori for the senate talk talk section, our senator tori say if dem fit ban dollar, naira…