Appeal court don still tori say Asue Ighodalo of PDP remain di candidate for di election

Appeal court wey sidon gidigba for Abuja don tok say Asue Ighodalo wey bi di gwornorship candidate for di pipo democratic party remain di authentic candidate for di election wey go take place on September 21 2024. Dem tori dis one as dem troway di mata wey som Pipo carry go court say make dem disqualify Asue Ighodalo sake of say him be nor get beta voter’s card, as dem dey giv d judgement, dem tori say dem dey troway dis mata becos of say di mata lack merit, and…

Peter Obi don ask African Leaders say make dem take farming business serious well well

Peter Obi wey bi di presidential candidate for di 2023 general elections and former Anambra state gwornor don advice African leaders to take agriculture business serious well well so dat dem go fit tackle insecurity and hunger for Africa. Na for di international conference for food security wey dem hold for Kigali for Kenyan nai him for tori dis advice. Obi com still tori further say e go beta to reduce dependency on food importation wey go help to reduce di currency pressure and focus more on food production for…

Quality infrastructure for china go soon dey appear for Nigeria

Presido Tinubu don tori say him go try to start to make di quality beta infrastructure wey him see for China to dey appear for di kontry. Presido tori dis mata give Nigerians wey settle gidigba for china wey dem dey call Nigeria diaspora organization for China chapter, presido tori say im ready to create di leadership wey go move di nation forward. Him com tori further say China na very discipline society so make di Nigerians wey dey stay dere learn discipline and represent Nigeria as good citizens.

FG don tori say di fuel scarcity wahala go reduce dis weekend

Federal gworment don tok say plenti borku fuel dey di kontri, and base on dat fuel scarcity go reduce afta dem address di distribution issue. Na Sen. Heineken Lokpobiri wey bi di minister of state for petroleum resources nai tori dis one afta him and Vice President Kashim Shettima hold meeting finish. Di minister tori say gworment dey do everytin possible to make sure say dis fuel scarcity so wey dey cos beta hardship for we citizens become a tin of di past Him com still tory say gworment nor dey…

Poyis for Edo don arrest Ibrahim Yahaya Jolly wey bi nadkippa

Poyis for Edo state don arrest one Ibrahim Yahaya Jolly wey dem say him bi kidnap one Igbinosun Evans, wey bi di leader of Ugbogui community for Ovia South-East local gworment area for di state. Dis informate reach di public as poyis informate SP Moses Joel Yamu take tori am. According to di further informate wey SP Yamu informate when him parade other suspects for some oda crime matas for di state, him say dem arrest Ibrahim Yahaya di kidnapper after him collect ransom of 7 million naira from Igbinosun…

NANS say dem nor dey plan any fuel increase protest

National association of Nigerian students NANS, don comout tori say, dem nor dey part of di pipo wey dey plan any protest on September 15th, 2024, dem say dem support anything wey go bring peace to resolve di mata of fuel increase. Afeez Akinteye wey bi NANS senate president nai tori dis one for e statement say, dat informate say NANS dey plan any protest nor carry beta jerrican of water, sake of say dem nor want anytin wey go cause kasala for di nation, but dem support say make…

Poyis don arrest one fake doctor wey go inject patience com kpai di patience for Nasarawa state

Poyis for Nasarawa don arrest Isa Usman wey bi fake docitor, sake of say him go give one patient wey dem dey call Zaki Yaka Ajohol procaine injection wey him say him take dey treat typhoid for Zaki Yaka, wey com later kpai Zaki di patient. Dis mata happen on Wednesday for Iyayi village wey dey Kadarko district of Keana local gworment area for Nasarawa. According to poyis informate, DSP Ramhan Nansel, wey confirm di arrest, com tori say di fake docitor wey com from Gombe state only get primary…

Nigeria electricity generation don reach 5,313MW first time in 3 years

Minister of power, Adebayo Adelabu, thru him special adviser for communication and media relations, Mr. Bolaji Tunji, don tori say for di first time in 3years, electricity generation don reach 5,313 megawatts. Di minister com tok say him go advise electricity distribution company wey bi Discos to collect more power so dat di national grid nor go collapse again, according to am, him say if Discos nor pick power when dem production energy, e fit lead to collapse of national grid. Di minster com further tori say, by di end…

Bill Gates say for Africa na Nigeria dey benefit pass from dia foundation

Bill Gates wey be co-chairman of di Bill and Melinda Gates foundation don tori say na Nigeria nai dey receive di largest intervention fund for Africa. Bill Gates say him understand why e bi like dat since na Nigeria nai still get di highest population for Africa, and na during di NutriVision wey him and some tori pipo dey rub mind for Abuja nai him for tori dis one, him com tok say him don really spend billion on top Nigeria. Him com tori further say e top priority na…

Dangote don promise Nigerians say dia motor go com dey last well well as from now

Aliko Dangote, di oga kpatakpata of Dangote group don tori say, since him don succeed to make di petrol mata wey bi dey get kleg since work, make Nigerians know say dia motor from now on go dey last well well, sake of say di petrol from Dangote refinery pure nor be small. Dangote tori dis one as him dey tori di pipo for one press conference for Lagos, him com tori join say, dis petrol from Dangote refinery pure so tey nobodi for di world in terms of quality…