Di anti narcotic force for Pakistan don arrest one Nigeria man for dia Lahore international airport sake of say dem find 38 capsules of cocaine inside him belle. Tori say di Nigerian man bi pass Dubai go di destination wey dem for catch am with dis amount of cocaine wey dem say e reach 608 grams inside di capsules wey him take arrange di cocaine before him swallow am according to wetin di Pakistan anti narcotic force spokesperson tok. Dem say dem don dey charge di man under dia anti…
Category: We DI People
Minister of women affairs don warn say any program must involve empowerment
Minister of women affairs, Uju Kennedy- Ohanenye don tori say, any program wey anybody dey plan to hold under di women ministry must receive her permission and must involve beta empowerment for women and children. Minister tori dis one for one event wey she go sanction, sake of say she nor giv di organizers her approval, according to di video wey dey circulate for social media, di minster tori say she don change di narrative and she nor care any name wey dem go call her. Madam Uju com tok…
Peter Obi don lambast di anti Yoruba Edo woman
Peter Obi wey bi Labour Party presidential candidate for 2023 general elections don lambast dat woman wey tok say she go personally start to kpai Yoruba and Edo people. Obi tory dis one for him X handle on Friday, Him tok say him totally condemn di hateful statement and actions wey di woman exhibit, say dat kai behavior and divisive comment nor get place for our community. Obi further tori say as Nigerians, e go good say make di pipo unite and focus to address di challenges wey di kontry…
Some of di pipo for Zamfara don by diaself kpai 37 bandits
Tori tok am say some very very brave citizens of Matusgi village, wey dey Talata Mmafara Local Government Area for Zamfara state don gather kpai almost 37 bandits as di bandits try to wan attack dia community to napkin some citizens for di area. Dem say di bandits dem bin enter di area around 2pm for afternoon to carry out di napkin mata, nai di citizens of Matusgi com provoke say enof is enof, say today na today as dem don understand say all kpai is kpai, and dem nor…
NCC don announce say na September 14 nai bi deadline for SIM-NIN linkage
Nigerian Communications Commission (NCC) don direct all mobile network operators to make sure say dem complete di mandatory verification and linkage of SIM to NIN by Sept. 14, 2024. Na di director of public affairs Mr. Reuben Mouka, nai tori dis statement on Wednesday say dis directive na to make say everybody follow di full compliance of di SIM-NIN linkage policy. Him com tori further say di linkage of SIM-NIN dey very important sake of say e go helep di trust and security of our digital economy.
Plateau assembly don reduce local gworment tenure to 2 years
Plateau house of Assembly don reduce di tenure of elected local gworment officials from 3 to 2 years. Na di house committee chairman on information Mr. Matthew Kwarpo nai tori dis one on Wednesday as e dey address tori pipo for Jos, him com tok say dis reduction from three to two years dey in line with di Plateau state independent electoral commission law of 2024 wey dem amend. Mr. Kwarpo com also tori say dem also take dis decision becos of di local gworment autonomy wey supreme court just…
Some kai protest dey happen for Canada as report say dem wan deport about 70,000 international students
Tori don carry say some kai protest dey go on for Canada sake of say dem wan deport almost 70,000 international students from Nigeria and oda countries dem. CityNews Toronto also tori for dia report say na some of di pipo from one student advocacy group wey dem dey call Naujawan Support Network, nai giv dem dis figure of 70,000 graduates wey dey at risk of deportation when dia work permits go expire by di end of dis year. Di gworment don first dey announce some kai tough rules wey…
One Airport worker with beta integrity for Kano don return $10,000
One young man wey dem dey call Auwal Ahmed Dankode wey bi staff of Nigerian Aviation Handling Company NAHCO don return $10,000 wey equivalent to almost 16-million-naira wey him see inside plane as him dey clean di plane for Malam Aminu International Airport for Kano. See as Zagazola take report dis integrity maa for dia X handle
NANS say dem go protest becos of di food wey NEMA divert
Di National Association of Nigerian Students (NANS) don tori say dem go start protest within 72 hours against di National Emergency Management Agency NEMA wey dem NANS dey accuse say dem use wayo wayo take divert food commodities wey belong to poor Nigerians. According to di statement wey NANS deputy senate presido Huzaifa Sabo Usman signed, dem tori say dem wan use di protest take draw Nigerians attention to how NEMA take use wayo divert almost 42,000 metric tons of food wey belong to di poor for kontry. NANS com…
FRSC don confirm say road crash don kpai 16 passengers for Benin-Ore road
Di federal Road Safety Corps FRSC for Ondo, don tori with confirmation say almost 16 pipo don kpai from di accident wey involve one motor bus and one truck, and three oda person com get serious injuriy join. Dem tori say na for Odigbo area for ondo state nai dis accident for happen so for night. Di Ondo Sector Commander for FRSC, Mr. Ibitoye Samuel, wey confirm dis mata on Wednesday, tok say na over speeding and yeye overtaking nai cause dis accident wey make di vehicles collide den com…